In pictures: Eid al-Fitr around di world

Eid al-Fitr

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims pray during di Eid al-Fitr celebration for Turin, Italy

Muslim worshippers around di world dey celebrate di festival of Eid al-Fitr, commonly known as Eid, to mark di end of di holy month of Ramadan.

Many Muslims go attend Eid prayers for dia mosque, early Wednesday 10 April.

Believers go also enjoy plenty food wit friends and family, and exchange money and gifts – For many kontris, Eid al-Fitr na public holiday.

Di name "Eid al-Fitr" e mean "di festival of di breaking of di fast".

Muslims wey take part for Ramadan no bin dey eat or drink during daylight hours, dem believe say e go bring dem closer to God.

Ramadan also na time wen dem dey encourage Muslims dem to give to charity, strengthen dia relationship withGod, and show kindness and patience.

Just like di beginning of Ramadan, Eid dey start wit di first sighting of di new moon.

See pictures from around di world wey show Eid prayers and celebrations.

Eid al-Fitr

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims offer morning prayers to start Eid al-Fitr festival for one street for Saint Petersburg
Emir of Kano
Wetin we call dis foto, Fotos of Eid climb wit di Emir of Kano Alhaji Aminu Ado Bayero for Kofar Kwaru afta Eid prayer
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims gada to perform Eid al-Fitr prayer for Abu Dhabi, United Arab Emirates
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslim women perform Eid al-Fitr prayers for Sultan Abdul Samad Jamek Mosque for Kuala Lumpur, Malaysia
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Iraqis gada for breakfast for one of di corridor for Basra Zubair district for southern Iraq afta di morning prayer
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mohamat Tahir Modoula, di Iman of Adré, lead di special morning prayer to start di Eid al-Fitr festival for Chad
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims arrive for one field during sunrise to offer special morning prayers to start Eid al-Fitr festival for Egypt
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Children join di morning prayer for Rashidiya Mosque for Basra Zubair district southern Iraq
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims gada for Fatih Mosque Istanbul to perform Eid al-Fitr prayer
Eid al-Fitr festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo dey gada afta dem perform Eid al-Fitr morning prayer for Doha, Qatar