Whatsapp come back afta ova one hour of outage

Pesin dey press phone

Wia dis foto come from, Getty Images

WhatsApp don come back up afta e go down worldwide.

Meta, wey get WhatsApp, say di problem don dey fixed but no give a reason for di down time.

Users across Nigeria bin put out over Seven hundred thousands Tweets about di mata for Twitter as at di time of filing dis report.

However, by around 11:00 WAT di service seemed to be returning for many users.

"We know say pipo bin get trouble sending messages on WhatsApp today," Statement from WhatsApp tok.

"We don fix di issue and apologise for any inconvenience."

As WhatsApp experience difficulties many pipo bin complain on social media say dem no fit send or receive messages.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

But no be only for Nigeria di complain bin dey.

WhatsApp users from around di world bin also dey social media platforms dey complain say di app no dey work.

Some pipo see say wen dem send message, e no dey land and di message dem go see na "connecting".

WhatsApp na one of di most popular messaging platforms for Nigeria and around di world, and e dey estimated say more dan two billion pipo dey use am around di world.

The outage dey likely to cause cause serious kasala as di app wey dey offer end-to-end encryption for messages na popular method of group communication for social, work and parenting activities.

Internet monitoring organisation NetBlocks bin say di outage dey affect users around di world.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2