European leaders promise to arrange new ceasefire deal for Ukraine for di London summit

Wia dis foto come from, Getty Images
Global leaders go meet for central London on Sunday, 2 March for one crucial summit to discuss di war in Ukraine.
Dis meeting dey come afta di Ukrainian President Volodymyr Zelensky and US President Trump chook leg put inside one trouser for di Oval Office earlier dis week.
UK Prime Minister Keir Starmer wey dey host di summit of European and Canadian leaders tok say di koko of di discussion na about support for Ukraine and on how to end di war.
Sir Keir ready to welcome Italy Prime Minister Giorgia Meloni to Downing Street dis morning.
Leaders of Denmark, Netherlands, Norway, Poland, Spain, FInland, Sweden, Czechia and Romania go also dey in attendance, Turkey foreign minister go also show.
UK PM also invite Nato Secretary General Mark Rutte, European Commission President Ursula Von der Leyen and Council President Antonio Costa.
Ukrainian President Volodymyr Zelensky, French President Emmanel Macron, German Chancellor Olaf Scholz and Canada Prime Minister Justin Trudeau go later join di leaders for di summit.
Ukraine allies discuss plans to end war wit US to go forward 'together'

Wia dis foto come from, Reuters
UK PM Starmer bin tok for di summit say, "for my tok-tok in di last few days, we don gree say a group of us go work wit Ukraine for plan to stop di fighting and dem we go carry am go tok wit US and carry am go front like dat."
End of Di one wey oda users dey read well well
E say "even as Russia dey took say dem want peace, dem still dey go on wit dia relentless aggression".
UK prime minister tok say di leaders for di summit bin agree on four important steps:
- To keep military aid flowing into Ukraine even as di war dey go on, and increase economic pressure on Russia
- Any lasting peace must ensure Ukraine sovereignty and security, and Ukraine must be dey for di table for any peace talks
- In di event of a peace deal, European leaders go aim to stop any future invasion by Russia into Ukraine
- "Willingness go dey" to defend Ukraine and guarantee peace for di kontri.
Oga Starmer tok say dem must back any new deal to support Ukraine wit strength, plus every nation must contribute for di best way dem fit, e say make all of dem take responsibility and step up for dia own share.
E add say, "for my tok-tok in di last few days, we don gree say a group of us go work wit Ukraine for plan to stop di fighting and dem we go carry am go tok wit US and carry am go front like dat."
E add say "even as Russia dey took say dem want peace, dem still dey go on wit dia relentless aggression".
Di President of Finland Alexander Stubb don back Sir Keir Starmer effort to arrange new European ceasefire plans for Ukraine.
E tell di gbas-gbos wey happun for di Oval office between President Trump and President Zelensky na "failure for diplomacy" and say na Vladimir Putin be di "only winner".
Nato chief Mark Rutte bin to three tins just bifor di Summit wey e say be di kono.
E tok for X say "all for Europe need give more" to support Ukraine, e add say "we all want peace deal wey go last" and Europe dey "really step up for here".
Dis na as Sir Starma biin tell di UK Baltic allies sorry say e no invite dem for di meeting.
Dis na as di Baltic kontris of Estonia, Latvia and Lithuania don tok taya say Russia fit face dem next as dem increase dia defense spending in di last three years.
Turkish Foreign Minister Hakan Fidan dey expected to chook mouth for di Summit and offer to hold peace tok-tok between Russia and Ukraine.
Di kontri bin host di first negotiations afta Russia bin invade Ukraine for 2022 wey clear road for di safe export of grain for di Black Sea.
UK PM meet wit Ukraine leader, sign £2.26bn loan to improve defence
Meanwhile, di UK and Zelensky don sign one £2.26bn loan for Ukrainian military supplies, dem go pay back di loan from di profits from seized foreign assets.
Dis happun during one meeting between President Zelensky and PM on Saturday.
Dis no be di first time dem go tok about dis loan, as dem don tok di mata of loan for October, 2024.
Oga Keir tell di Ukrainian leader say di hailing wey im dey get during dia meeting na "di pipo of United Kingdom dey show how dem support you, how dem support Ukraine".
For di Ukrainian leader visit wey start on Saturday, Zelensky dey expected to meet King Charles bifor di summit as Zelensky bin request and di United Kingdom goment bin approve.
Afta di Downing Street meeting, Zelensky praise di UK "ogbonge" support especially for di £2.26bn loan wey dey paid for wit Russian assets wey dem don freeze since di start of di war, e say, "dis na true justice, di one wey start di war, must to be di one wey go pay."
Dis na as e tok say dem go carry di money to dey make weapons for Ukraine.















