Narendra Modi declare victory inside a closer dan expected Indian election

Bharatiya Janata Party (BJP) supporters celebrate at BJP headquarters in Bangalore, India, 04 June 2024.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Prime minister Modi dey on course to win a third term
    • Author, Simon Fraser
    • Role, Asia online editor, London

According to India Election Commission website, di ruling NDA alliance wey dey headed by Narendra Modi BJP don currently win 274 seats – taking dem over di number dem need to form a government.

Di BJP get 226 confirmed seats on dia own.

While di opposition INDIA alliance get 193 seats.

Prime Minister Narendra Modi bin don already claim victory for di Indian election, although im alliance dey far short of di 400 seats e bin set out to win

A party or alliance wey win more dan 272 seats for di 543-member parliament fit form di government

Speaking in Delhi, e don thank voters for dia mandate, and vow to end poverty

Di world biggest election bin happen for seven phases over six weeks with almost one billion pipo wey register to vote.

Many pipo bin see di election as a referendum on Oga Modi ten years for office, wia im don transform many aspects of life for India.

'Biggest victory in the world'

Speaking for di BJP headquarters for Delhi, Indian Prime Minister Narendra begin by leading di crowd in a chant of "Long live Mother India", and come thank im supporters for dia "blessings".

"From my heart, I dey very, very happy today," e tok.

Prime Minister Modi say im alliance, di NDA, "continue her time" and go form a government.

"Today victory na di biggest for di world," e tok, describing am as "victory for di Indians".

E thank di election committee for dia work, especially inside di "extreme hot weather".

"Dem do am with so much skill... many polling stations bin dey", e tok, adding say every worker "done do dia duty and dem don fulfil dia responsibility".

BJP supporters are still smiling - but the race is tighter than expected

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, BJP supporters still dey smile - but di race tight pass as dem expect am

An average 66% of voters bin take part for di election, official figures show. Na di biggest exercise di world don ever see, wit nearly a billion registered voters – dat na about one in eight of di global population.

Dem stagger di voting ova seven rounds between 19 April and 1 June for security and logistical reasons. Much of di election bin take place for extreme and deadly heat as temperatures for parts of India high reach nearly 50C.

India election

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Congress supporters for Delhi dey celebrate di opposition performance

Di BJP and dia rivals fight bin tough - dem bin dey insult dia self for- campaign at times, di prime minister deny say im bin dey divisive wen im rivals bin accuse am say im demonise Muslims.

Oga Modi bin tour di kontri, to tok about im achievements for areas like delivering welfare schemes and raising India global profile.

Opposition parties hala about di high unemployment - especially for young pipo - and fear say im plan of constitutional changes fit make pipo wey no too get mouth weak more-more. Dem also promise to stop India “slide into autocracy”.

In recent years, some opposition leaders and goment critics don go jail, including Delhi chief minister Arvind Kejriwal wey dem take into custody on corruption charges for April but later dem briefly release am to allow am to campaign.