US don increase visitor visa validity for Nigerians

Pesin dey show inside dia passport

Wia dis foto come from, Getty Images

Di United States of America don increase di visitor visa validity for Nigerians from 24 months to 60 months for no extra money.

Di visa dey cover Nigerians wey wan enta America for tourism or to do business for short time bifor you go need renew visa.

According to statement by di US embassy to Nigeria, dem reveal say di reason na to dey reduce visa appointment wait times for Nigeria.

Di visa application fee go remain US$160 even wit di time extension.

Dis time extension go start from March 1, 2023.

Also as part of tins to take reduce long visa appointment waiting time, dem don also arrange No Interview Visa renewal for academic only and combined only visas.

Criteria for Non Interview Renewal

  • You dey Nigeria physically
  • Your previous visa bin dey issued for Nigeria
  • Your former visa dey for di same classification as di one you dey apply for
  • Your former visa na full-validity, multi entry visa
  • Your former visa expire within di last 48 months or go expire for di next 3 months afta you apply
  • You get all di passports wey cover di entire period since you get your last visa and di passport wey get di most recent one
  • Dem neva arrest or convict you for any crime or offense for America, even if you collect waiver or pardon later.
  • You neva work for America without permission or star pass di time dem give.