‘I go defend my record for di World Championship’

Tobi Amusan

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigerian athlete Tobi Amusan don ready to defend her record for di World Athletics Championship for Hungary.

She tok as she react to suspension wey Athletics Integrity Unit (AIU) remove for her ahead.

Di AIU on Thursday announce say dem don clear Amusan of doping violations.

Di unit for July bin provisionally suspend di women’s hurdles record holder for missing three drug tests within 12 months – she bin also dey face a two-year ban if to say dem find am guilty.

Di tori worry many Nigerians especially her fans wey dey expect to see her for oda competitions.

Sake of di matter di Athletics Federation of Nigerian (AFN) even comot Amusan from di list of athletes wey go represent di kontri for di World Athletics Championship wey dey start on Saturday.

But AIU on Thursday evening – two days to di Championship for Budapest, Hungary announce say Tobi Amusan dey innocent.

“A panel of di Disciplinary Tribunal, by majority decision, don today find say Tobi Amusan never commit any Anti-Doping Rule Violation (ADRV) of three Whereabouts Failures within a 12-month period,” di Athletics Integrity Unit (AIU) tok for statement.

“AIU Head Brett Clothier don indicate say di Athletics Integrity Unit (AIU) dey disappointed by dis decision and go review di reasoning in detail before deciding weda to exercise dia right of appeal to di Court of Arbitration for Sport (CAS) within di applicable deadline.

“Di decision currently dey confidential but go dey published in due course. Amusan provisional suspension don dey lifted wit immediate effect.”

In her reaction wey she post on social media Amusan tok say she go put evri tin wey don happun behind her and defend her World Championship next week.

“I find say di independent tribunal hear my case and dem rule say I no violate rules and as a result I no go dey sanctioned and my results no go dey prevented.

I go put dis behind me and I go consistently dey support clean sport,” she tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be Tobi Amusan?

Tobi Amusan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tobi Amusan

Oluwatobiloba Amusan na Nigerian Hurdler.

Dem born her on April 23, 1997 and she from Ijebu-Ode

She dey school for University of Texas, afta she finish from Our Lady of Apostles Secondary school, Ijebu-Ode.

She finish 4th for di 2020 Tokyo Olympics and she just set new African record.

She be Nigeria National Champion and currently rank No 3 for di world.

She don win plenti Gold medals for Nigeria, especially for di Commonwealth Games.

African Games and di African Championships both for Relay.

Wit dis new African record, Amusan go be one of di top athletes from Africa wey pipo go wan see how she go perform for di upcoming 2022 World Athletics Championship for Oregon, United States of America next month and di Commonwealth Games for Birmingham, England from July 28 to August 8.