‘Dem kill my favourite child’ - Papa of di five children wey dia stepfather set on fire

Di papa of di five children wey dia stepfather set ablaze for Ondo state, southwest of Nigeria say im shock wen e receive call say im children dey involved for one fire incident.
Oga Akinfolarin Liadi wey be tractor driver say im bin dey sleep wen e receive di phone call around 4am for Saturday morning say fire dey burn for im ex-wife house.
"Dem tell me say fire, dey burn for my ex wife husband house, I ask dem wetin concern me wit her husband house.
"I ask dem wetin dem want make I go do for di house before di husband go begin think say I still wan date im wife."
Oga Liadi say dem later call am back and hand over di phone to im first daughter wey begin dey shout "my daddy, my daddy fire dey burn".
Di tractor driver say im quickly rush out of bed dey go di house
“I cry wen I see dem . Dem don ruin my children life."
Im tell BBC say dem bin dey on dia way to di hospital wen one of children die.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We no fit remove am from di ambulance, I carry im leg, e no dey answer us again.
“Dat na my favorite child, e die on our way to di hospital, di burnt too much and we no fit save am." Oga Liadi tok.
Ondo State Police bin confam give BBC say di youngest of di five children bin burn for di house beyond recognition.
Oga Liadi also confam as at di time of dis interview wit BBC, say three of di children don die and two of dem still dey critical condition for hospital.
Di tractor driver say she and dia mama go dia separate ways for 25 December, 2020.
Im tok say dem separate sake of alleged infidelity on di part of di woman.
“I no wan follow wia I take come to go back, na why I leave am.” Oga Liadi tok.
“And no be me pursue her, na she pack comot from house by herself.” Im tok.
Esther admit say Oga Liadi bin dey work for a different town and im no go fit look afta di children.
Although she no tell us why she and Oga Liadi separate but she say she bin no fit leave di children wit am because im no go dey house and nobody go look afta dem wen im go work.
And she tell BBC say di children dey go meet dia papa and spend time wit am every weekend.
“Dem bin dey plan to go see dia papa on Saturday before di fire incident happun overnight.
She tok say na im dey take responsibility of di children school fees and oda things.
Meanwhile, Authorities for Ondo state southwest of Nigeria confam say dem arrest di 54-year-old man afta im allegedly set ablaze im five step children on Friday night.
Oga Ojo wey be di suspect still dey for police custody as dem dey investigate wetin lead to di incident.
‘Mummy fire dey burn’, mama of di five children narrate how e happun

Esther Ojo Madam Esther say dem bin dey sleep for night around 3am wen one of her pikin wey dey about 17 years shout from dia room say ‘mummy fire dey burn’.
Di 35-year-old tok say her husband bin come home dey vex dat day before im later go buy petrol keep for house, tell am say e dey carry am go work di next day.
“I bin no fit sleep dat night because wen my husband come house, I just notice say e dey vex.
“I greet am e no ansa me, but I see say for night im waka comot from house go buy petrol.
“E go hide di petrol tok say im wan use am go work di next day becos im be operator
“For night I notice say im no gree sleep, I ask am wetin happun but e tok say nothing. Me sef dey fear because I dey wonder wetin fit dey worry am.
Madam Esther say she later fall asleep around 3 am before she suddenly hear her first daughter dey shout from dia room say ‘mummy fire dey burn, fire dey burn.
She say by di time she stand up to go meet di children for dia room, she see say fire don dey burn dem and di first daughter tok say na daddy dem see wey stand for door pour something for dia bodi.
Wen Esther enta di room to go save di children and carry di youngest of dem, fire also catch her and she sustain minor injuries.
"Wen fire burn me, I no fit save my child, na why she burn be dat", she tell BBC from di hospital bed wia she dey receive treatment.
'Im bin don tell me to carry di children go give dia papa'
Esther say she and Oga Ojo don dey married for about five years.
Before dia marriage she bin don get five children for anoda man before she later born twins for her present husband.
She tok say im bin don complain before say make she carry di children go give dia papa
“I tell am say I no fit carry dem go because e see say I don get children before im marry me
“E dey hard to leave di children alone for dia papa house becos im dey go work and nobodi go look afta dem wen im no dey house.
“And e tell me say im don hear.”
She tok extra give BBC say she and di suspect dey fight evriday , sometimes because of moni.
Im go dey complain say e no get enough money to feed us, she add.
She say di husband go most times dey complain say she don give all di food wey dey for house to her children.
She also say her husband bin dey try run away wit di twins wey dem born togeda before police arrest am.
“Nothing happun to di twins, Im don carry dem wan run comot for house but our neighbours bin don call police.
“Dem carry us go different hospital for Ondo but dem reject us, by di time wey di taxi driver return us back home, we see say im wan dey run wit di children wey I get for am.” She tok.













