'Your English fine well-well' - Key moments from Trump meeting with five African leaders
President Donald Trump don meet with five African leaders on di first day of im three-day summit for Washington DC wit di leaders of five African states.
Di meeting according to di White House na an "incredible" commercial opportunity.
Trump guests include di leaders of Gabon, Guinea-Bissau, Liberia, Mauritania and Senegal - none of whom wey represent di major economies of di continent.
Di meetings dey expected to concentrate on Trump "trade, not aid" policy and with all of them facing 10% tariffs on goods wey dey exported to di US, dem fit dey hope to do deals to negotiate dis rate down.
But on di first day of dia meeting, one of di major moments wey dey trend na di moment di US president hail Liberian President Joseph Boakai for im English.
Trump tell Boakai say e speak "such good English" come ask am wia e take go school.
But di African oldest republic, Liberia dia official language na English.

Wia dis foto come from, Getty Images
Oda key moments from di meeting between di African leaders and Trump
- African Leaders tell Trump say e reach for am to win Nobel Peace Prize and oda hailings
Mauritania President Mohamed Ould Ghazouani first tok about how President Trump bin facilitate di peace deal between DR Congo and Rwanda. Dis bin come wit agreements from di oda African leaders say Trump suppose dey nominated for Nobel Peace Prize.
Dis dey come as Senergal President Bassirou Diomaye Faye also hype Trump for im golf skills say make e come build golf course for Senegal. To which Trump tok say, "I no know say dem go treat me dis nicely. We fit do dis all day long".
- African leaders call for investments from US
Di African Heads of States also use di opportunity take hype up di respective natural resources and raw materials wey dem get wey include rare earth minerals, wit some of dem wey ask US investors and di president directly to come invest.
Faye say e wan build "tech city" for Dakar wit "views of di sea" and tok say e wan invite American investors make dem dey part of am.
Gabon President Brice Clotaire Oligui Nguema tok say im kontri get plenti resources including rare earth minerals, im invite Americans to come invest put "or else oda kontris fit enta instead of you."
- Gabon get hope of 2 to 3 billion dollars financing
Gabon President Nguema later reveal say e tell President Trump about all di beta tins wey im kontri don do since di coup wey happun on August 30, 2023.
For statement wey di Gabon Presidency release afta, e torchight say im kontri wan start tok-tok wit make di America Development Financial Institute (US-DFC) and EXIMBANK to get financing of about $2 to 3 billion to fit finance di development projects, di 901 km Belinga-Boué-Mayumba railway line project for di transport of iron ore; di Boué hydroelectric dam among odas.
- Ending of USAID
President Donald Trump torchlight di USAID closure wey don already start say na to eliminate waste but e get plan for new economic opportunities.
E tok say, "we don close di USAID group to comot waste, fraud and abuse... and we dey work tirelessly to ginger new economic opportunities wey go involve di US and many African kontris."
- Liberia President Meeting wit Deputy Secretary of State Christopher Landau
Di Liberian leader follow di US Deputy Secretary of State, Christopher Landau meet to tok about how to collabo for commercial projects like mining, small business development and oda provide enterprise.
Di deputy also welcome Liberia presence for di UN Security Council for dia 2026-2027 term say make di two kontris dey work togeda for shared interest.





