How Nigeria medal hopefuls miss out on Day 11 of di Olympics

2024 Olympics

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Blessing Oborududu/Favour Ofili
Read am in 4 mins

Di hope for Nigeria contingent wey go di 2024 Olympic games for Paris, France to win medals dey become slim evriday.

Dis na as Favour Ofili and Blessing Oborududu miss out of medal placement on Day 11 of di ongoing Olympics.

Favour Ofili wey run for lane nine finish 6th for di Women 200 metres final with a time of 22.24.

Gabrielle Thomas of USA win di race wit a time of 21.83 to win Gold, Julien Alfred of Saint Lucia finish second wit 22.08 to win Silver while Brittany Brown of USA win Bronze wit a time of 22.20.

For di Bronze medal fight for, wrestling Tokyo 2020 Silver medallist Blessing Oborududu also lose 3-0 to her Japanese opponent for di 68kg Freestyle.

Favour Ofili bin run her season best of 22.05s to finish second just behind Julien Alfred wey win di race to qualify for di final on Monday.

She be three-time world championships semifinalist - 400m for 2019, 200m for 2022 and 2023.

Ofili wey be first time Olympian na di first Nigerian woman to qualify for di final of di 200m at di Olympics in 28 years.

Di last time a Nigerian make di final of women 200m na for Atlanta 1996 wen Mary Onyali win bronze medal.

For Blessing Oborududu, she bin win Nigeria first Olympics medal ever for wrestling for 2020 Olympics for Tokyo.

2024 Olympics Favour Ofili and Julien Alfred

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Julien Alfred of Team Saint Lucia and Favour Ofili of Team Nigeria compete during di Women 200m Semi-Final on day ten of di Olympic Games Paris 2024 for Stade de France on August 05, 2024 for Paris, France.

Blessing Oborodudu lose wrestling bronze medal event

Oborududu, wey don lose di bronze medal match to her Japanese opponent 3-0 bin lose her semi-final match against Meerim Zhumanazarova of Kyrgyzstan 1-3 on Monday, wey for see her reach anoda Olympic final.

Di semi-final bout of di women 68kg wrestling event for 2024 Paris Olympics bin take place for di Champ-de-Mars Arena.

Earlier Oborududu bin defeat her Canadian opponent, Linda Morais, 8-2 for a place for di quarter-final.

She enta mat again for di quarter-final and defeat Larroque Koumba of France 6-2 to kotinu her good start for Olympics bifor she lose her semi-final to Zhumanazarova.

Favour Ofili 200m final history

Ofili make history on Monday by becoming di first Nigerian woman in 28 years to reach di 200m final, matching Mary Onyali achievement for di 1996 Atlanta Olympics.

She achieve a personal season best of 22.05s, to finish second for her semi-final heat behind Julien Alfred, wey be di reigning Olympic 100m champion.

How oda Nigerians perform on Day 11

Three Nigerians Ese Brume, Ruth Usoro and Prestina Ochonogor don qualify for di Long Jump finals.

According to di Ministry of Sports for Nigeria, since di African kontri start to compete for di Olympic Games since 1952, no three athletes don qualify for finals of di same Individual event bifor.

Ese Brume wey win bronze medal for Tokyo 2020 Olympic jump 6.76 metres for her last attempt to qualify.

Ruth Usoro jump 6.68 metres to get her first Olympic final spot and na also her first time to compete for Olympics.

Prestina Ochonogor jump 6.65 metres to also qualify for di finals for her first time Olympics .

Nigeria goment dey happy for dis qualifications sake of say hope dey, if out of di 12 finalists three na Nigerians.

"Dis na historic moment for Nigeria and I dey beg our athletes to do dia best for di final" Senator John Owan tok for statement.

Di final go shele on Thursday, 8 August, 2024 by 7pm Nigerian time.

Meanwhile no be good news for Nigerian Record holder, Chinecherem Prosper Nnamdi wey compete for di men Javelin event.

Nnamdi finish 14th from im qualification group wit a throw of 77.53m.