Uefa Europa League standings, results and fixtures: Manchester United get first win under new boss Amorim

Rasmus Højlund celebrates his winning goal against Bodo/Glimt

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rasmus Højlund score two goals as Manchester United come from behind to win Bodo/Glimt
Read am in 4 mins

Manchester United secure dia first win unda new manager Reuben Amorim on Thursday as dem come from behind to beat Norwegian club Bodo/Glimt 3-2.

Rasmus Højlund na di star of di match with two goals and one assist for Alejandro Garnacho who bin open di scoring for di first minute of di game.

Bodo/Glimt no appear intimidated by di Old Trafford crowd as dem equalise and also take di lead all bifor di half-hour mark.

However, United rallied round and later take over di game wit Højlund scoring di equaliser for di stroke of halftime, and add anoda shortly after second half start.

Dis win take di Red Devils to 12th position for di Europa League table wit nine points from five matches. E mean say Reuben Amorim boys still dey within di play off place to qualify for di round of 16.

For di oda matches on Thursday, Tottenham play 2-2 draw wit AS Roma wit Mats Hummels scoring a stoppage time equaliser for di Italians.

Victor Osimhen also dey di scorsheet for im club Galatasaray as dem play 1-1 draw wit AZ Alkmaar of Netherlands.

Europa League 2024/2025 matchday five results

Europa League 2024/2025 matchday five results - Thursday, November 28, 2024

Wia dis foto come from, BBC Sport

Europa League 2024/2025 matchday five results - Thursday, November 28, 2024

Wia dis foto come from, BBC Sport

Like di Champions League, di new Europa league format no get group stage rather, na team of 36 clubs wey go first play eight matches - four home and four away.

Afta di first round, di first eight teams for di table go qualify automatically for round of 16, while position 9-24 go play play-offs to know who go enta round of 16.

Position 25 - 36 go dey eliminated from di tournament.

Europa League standings

Europa League 2024/2025 table after Matchday five

Wia dis foto come from, BBC Sport

Europa League 2024/2025 table after Matchday five

Wia dis foto come from, BBC Sport

Europa League 2024/2025 table after Matchday five

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wen di 2024/25 Europa League knockout phase dey start?

Knockout phase play-offs: 13 & 20 February 2025

Round of 16: 6 & 13 March 2025

Quarter-finals: 10 & 17 April 2025

Semi-finals: 1 & 8 May 2025

Final: 21 May 2025

Wia dem go play di Europa League final for 2025?

Di 2024/25 Europa League season final go take place for di San Mamés Stadium for Bilbao, Spain, on 21 May 2025

Dis venue na a 50,000 capacity stadium wey also be di home of Athletic Club for La Liga.

Winners go gain automatic qualification to di league phase of di 2025/26 Uefa Champions League, even if dem no qualify through dia domestic competition.

Uefa Europa League

Wia dis foto come from, Getty Images