‘I go start from wia Adams Oshiomhole stop’ - Monday Okpebholo

‘I go start from wia Adams Oshiomhole stop’ - Monday Okpebholo

Edo state Govnor-elect Monday Okpebholo speak afta Nigeria election join-bodi di Independent National Electoral Commission, Inec declare am winner of di Edo gubernatorial polls.

APC Okpebholo get 291,667 votes to beat in closest rival PDP Asue Ighodhalo wey get 247,274 votes.

While di Labour Party and im candidate Olumide Akpata poll 22,763.

Speaking afta Inec return am as Govnor-elect, Okpebholo say:

"I thank Edo pipo for voting di right pesin for di job, a new Edo dey rise, I dey here to develop Edo, I wan transform Edo to di way e suppose be. " E tok.

Sixteen men and one woman, 17 political parties na im contest for dis ogbonge position of govnor of Edo State.

Di gubernatorial election wey be one of di off-cycle elections for 2024, take place across di 18 local goment area for di state.