'Many family members no know say I dey live wit HIV'
'Many family members no know say I dey live wit HIV'
- Author, Mansur Abubakar
- Role, Journalist, BBC Pidgin
Halima (no be her real name) dey among di pipo wey dey live with human immunodeficiency virus wey pipo sabi as HIV for Kano state, northwest Nigeria.
HIV na di virus wey dey attack di immune system and if e dey untreated e fit lead to AIDS - disease wia di body no fit fight off even mild infections.
Di 35-year-old say one of di top three things wey dey worry her pass at di moment na say she no get pikin of her own.
Di woman wey don dey with di disease for 19 years tok say na only her mama and a few oda pipo know because she dey fear stigma.
“Even my extended family members none of dem dey aware because I dey fear stigma from dia side na why I no wan make dem know.”
Video Journalist: Gift Ufuoma








