Ugandan Olympian wey her ex-boyfriend kill don make her final journey home

Wia dis foto come from, Peter Njoroge / BBC
Ugandan Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei wey her former boyfriend use fire kill, don dey buried for her papa village for eastern Uganda.
As she be member of Uganda armed forces, sojas bin carry her coffin and she collect three-volley salute.
Fellow athletes wey wear black t-shirt wey tok "say no to gender-based violence" na among di pipo wey go Cheptegei burial for her home town of Bukwo.
Kenya Sports and Youth Affairs Minister Kipchumba Murkomen tell di mourners say "we dey guilty as goment but di community also dey guilty."
"Make we tok true. No be true say we no sabi say even for local community say Rebecca bin get family problems."
One of her teammates wey follow am go di Paris Olympics, Stella Chesang tok say, "na very sad moment for Uganda... and all of us friends. As team wey go Paris togeda wit Rebecca we feel am wella bicos... we bin dey togeda, enjoy togeda and e dey really sad".

Wia dis foto come from, Peter Njoroge / BBC
Before her burial, local leaders bin hold memorial service for Cheptegei as dem cover her coffin wit Ugandan flag.
Dem observe a moment silence and standing ovation as part of dia respects to di late athlete.
Councillors say Cheptegei bin live "simple and focused life" and dey always guide her fellow athletes. One of dem tok say, "she bin inspire many pikin dem for di area to join athletics."

Wia dis foto come from, Peter Njoroge / BBC
Dickson Ndiema attack Cheptegei wit fuel less dan two weeks ago outside her house for north-west Kenya near wia she dey train.
Di way di 33-year-old killing happun make her family sad and shock odas from around di world.
E torchlight di high level of violence against women for Kenya and also torchlight say plenti female athletes don turn victims in recent years.

Wia dis foto come from, EPA
Cheptegei get full military honours for her burial sake of say, she bin dey work as member of di Ugandan armed forces.
Meanwhile, Rebecca Cheptegei home district, Bukwo in eastern Uganda, bin honour di late athlete by moving a motion to name one road and a sports venue after her.
Local leaders bin organise memorial to remember di late marathoner.
Councillors from Bukwo district for Mount Elgon region say Cheptegei live "a simple and focused life" and bin always dey offer guidance to her fellow athletes. "She inspire many children in di area to join athletics," dem tok during di memorial service ahead of her burial.
During di session wey happun for Bukwo district hall, di councillors observe a moment of silence and give standing ovation as dem pay respect to di late athlete. Di military band play di Ugandan and East African anthems.

Wia dis foto come from, Getty Images
Cheptegei bin die for hospital four days afta di attack. Doctors say she suffer burns for 80% of her bodi wey "cause multiple-organ failure".
Ndiema, wey follow burn as fuel touch im own bodi during di attack, also die on Monday.
E attack di mama of two wen she dey come from church, for di God's Dwelling Ministry.
Di pastor for dia remember Cheptegei say she be "wonderful... God-fearing pesin".
Afta she hear wetin happun, she manage follow Cheptegei tok for phone wen di runner still dey hospital.
Di pastor tell BBC Africa Daily podcast say she first ask about her pikin dem, wey dey fine, bifor Cheptegei start to dey enta her attacker mata: "You mean say Dickson no fit see wetin I don do for am? E no fit remember one or two wey I don do for am and no set me on fire? Why e do dis kain tin to me?"

Wia dis foto come from, EPA
On Friday, family, friends and activists against gender-based families bin go look her coffin for di funeral home for di Kenyan town of Eldoret bifor dem carry am go.
Her mama, Agnes Ceptegei cover her face, as she dey cry, as she carry one souvenir bag wey di athlete bin collect for di recent Paris Olympics, wia she come 44th for marathon.
Di mama wear t-shirt wia dem write "being a woman no suppose be death sentence".
Cheptegei, di marathon runner na di third female athlete wey dem go kill for Kenya in di last three years.
For each of di case, na former or present lovers na im di police don name as main suspects.
For 2021, dem stab world record holder, Agnes Tirop to death and six months later, dem strangle Damaris Mutua.

Wia dis foto come from, Getty Images
Attacks on women don turn major gbege for Kenya. For 2022, at least 34% of women say dem don face physical violence, na wetin one national survey tok.
Some observers tok say female athletes don dey turn target more and more.
Joan Chelimo wey join start Tirop's Angels to torchlight violence against women tok say di reason na "bicos dem no dey follow di traditional gender norms wey woman go just dey kitchen, dey cook and take care of pikin. But now, female athletes don dey more independent, wit money sef, dem dey independent".
Rachel Kamweru wey be tok-tok pesin to di goment department for gender and affirmative action, tell BBC say, "we no want make dis kain tin happun to any oda woman, weda na athlete o, or come from village o, or na small girl".
Wen Cheptegei start to dey run, she enta di Uganda Peoples Defence forces for 2008 wey follow support am.
Her last race na for Paris Olympic. Even though she carry 44th position come house, pipo for her yard still hail am say she be "champion".
She bin win gold for di World Mountain and Trail Running Championships for Chiang Mai, Thailand for 2022.
More pictures from Cheptegei burial activities
Hundreds of people including leaders from her home country, Uganda, and neighbouring Kenya, wia Ms. Cheptegei live and train, bin dey expected to attend di funeral. Di service happun for di Amanang senior school for di district where dem give Cheptegei military honours.
Dem bury Cheptegei for her father place for Kapkoros.

Wia dis foto come from, Peter Njoroge

Wia dis foto come from, Peter Njoroge

Wia dis foto come from, Peter Njoroge

Wia dis foto come from, Peter Njoroge









