Euphoria - Kendrick Lemar, Drake beef carry oda rappers join body

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mark Savage
- Role, Music correspondent, BBC News
US rapper, Kendrick Lamar don drop anoda diss track wey im come for fellow rap star Drake, wey don ncrease di beef wey dem get.
E call di song Euphoria and na ansa to weeks of yabis wey Drake don sama Lamar for plenti diss tracks.
For ova six minutes, Lamar call Drake say e be "manipulator and habitual liar", and also call am out on im parenting skills.
E say di Canadian star bin sell out, and say e dey make music to "pacify" im fans.
For dis song, nobody fit second guess wetin e dey feel for Drake.
E rap say: “Dis no be about critics, no be about gimmicks, no be about who be di gratest
“E don always be about love and hate, now make I tok am, I be di biggest hater.
“I hate di way you waka, di way you tok, I hate di way you dey dress.”
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis two rappers don dey beef each oda since 2013 wen Lamar just dey enta di game,
For one performance wey Lamar do for BET Awards wia im bin boast od im skills say e don "put one sensitive rapper back for im pyjamas".
Pipo say di line na about Drake, wey im blend of rap and R&B don change di sound of hip-hip.
Di beef bin pause for some years bifor e come back again last year afta J Cole and Drake bin add Lamar and call demselves di "big three" of rap for dia song First Person Shooter.
Nobody ansa dis line for months. No be until di middle of March wey Lunar come give one ogbonge verse for di song Like dat wia im say dem be no "big three - na just big me".
For April, Drake release di first diss track on top di mata wey im call Push Ups wia im yab Lamar say im short plus im collabo wit Maroon 5 and Taylor Swift.
Later dat month, Drake come drop anoda song wey im call Taylor Made Freestyle wia im yab Lamar say im be coward bicos im no gree ansa am back.
Di song use di AI version of Snoop Dogg and late Tupac Shakur, wey be one of Lamar heroes.
Afta Shakur estate complain, Drake comot di song from im Instagram.
Lamar for di Euphoria diss track also call Drake out on im use of AI say e go "make Tupac turn inside im grave".
E follow dat one to ask say "Am I battlin' ghost or AI?" wey be reference to di accuse wey don face Drake bifor say im bin dey use ghostwriters do im rap.
As to why e bin take Lamar dis long to diss im own back on Drake, e lambast am say:
"Una tink say all my life na about rap? I get pikin to raise but I see say you no know anytin about am."
Lamar wey bin win Pulitixer Prize for im fourth album, Damn, use dis Euphoria song to show di skills of im vice and im bin dey go from one flow and rhythm or beat sef throughout.
For di end, e be like say e follow yan Drake Toronto accent.
But for di fans wey bin dey hope say Lamar go use dis diss take do Drake TKO, dem go dey disppointed.
Bicos Lamar no ansa Drake wey call im wife for im last song but also admit say:
"I like Drake wit di melodies, I no like Drake wen e dey act street,
"We no need to take am personal, na just friendly yab, make you keep am like dat."
Dis beef ova di last few months don carry oda rappers follow bodi, as Kanye West, The Weeknd and Rick Ross don tok about di beef for dia latest songs.
Drake don also respond to dis Lamar Euphoria for Instagram, wia e take snapshot of one scene for di 1990s romcom, 10 Things I Hate About You, wia di main actress bin dey read poem wey she write about di tins wey she no like about her love interest.

Wia dis foto come from, Drake/Instagram
Drake put wia she tok say, "I hate your big dumb combat boots".
Tori be say na to mock di lyrics wey Lamar put for im song, but Drake fit no remember how dat scene finish bifor im carry am ansa Lamar diss track.
Bicos for di end, di main actress dey try make she no cry wen she say, "I hate di way I no hate you. No even close, not even a little bit."












