Rwanda music star Yvan Buravan don die for age of 27

Wia dis foto come from, Facebook/YvanBuravan
Yvan Buravan, one Rwandan R&B star don die of pancreatic cancer for di age of 27.
Im manager confirm di news of Buravan death give di BBC.
“E go too soon leaving behind plenti of things wey no dey yet to finish, but e leave us with amazing arts wey e don do.
Im legacy go live on”, e manager Bruce Intore Twagira tell BBC Great Lakes.
Dem bin dey treat Yvan Burabyo [im real name] wey dey well known as Buravan for India.
E bin don receive treatment for Rwanda and Kenya, before dem transfer am go India.
Di management of di Rwandan R&B star also put up statement for im Instagram page to announce e death;
“Na with unimaginable sadness we dey announce to you di untimely passing of our beloved Yvan Buravan wey occur for India, where e dey undergo treatment for Pancreatic cancer.”
End of Di one wey oda users dey read well well
“Yvan Buravan na genuine soul wey radiate happiness to everyone around am. E motivate all of us to love our kontri and our culture.”
“Im family, friends and our industry go really feel di loss.”
We dey certain say our community go remain united, as we go through dis unspeakable tragedy.”

Wia dis foto come from, Instagram/Yvan Buravan
For August 4, one statement for Buravan Instagram handle notify im friends and fans about e medical treatment.
“Yvan Buravan go like to let im friends and fans know say e dey abroad for medical treatment,” di statement tok.
“E thank di family and di goment of Rwanda for di assistance with im medical care and all those wey dey keep am for dia prayers and dey wish am recovery."
Dem discover Yvan Burabyo talent wen e come out second for one national music competition for di age of 14.
Im hit song ‘Malaika’, wey e release for 2016 make am enta stardom for Rwanda.
Many Rwandans on social media dey mourn im death.
Who be Yvan Buravan?

Wia dis foto come from, Facebook/YvanBuravan
Yvan Buravan na Rwanda finest music artist and one of di African superstars wey dey mostly recognize for East Africa and kontri members of Francophonie.
E be also songwriter where im tag na: “sing to express not to impress”.
“Buravan” stand for Burabyo Yvan wey be im real name.
According di bio for Yvan Buravan website, dem born am on 27th April 1995 and e be di last born for family of 5 boys and one girl.
Yvan Buravan music focus on romantic love, justice, peace, and reconciliation.
Yvan Buravan work and recognition
Yvan Buravan dey well receive across di continent since di release ofim first album: “The Love lab ”.
Dem don invite am to perform for di “Amani Festival” for RDC.
E also don get invite to perform for one of di biggest festival for Africa “FEMUA FESTIVAL” for Cote d'Ivoire.
For 2018 e win one of di biggest African music contest ‘Prix Découvertes’ wey Radio France international (RFI) and UNESCO organise.
Yvan Buravan don receive community recognition like di Agahozo Shalom village award 2019.
E dey known as “Opus celebrity of di year”, Mahatma Gandhi University award of achievement, Bestvideo and audio of di year, and many more.
Wetin be Pancreatic cancer?

Wia dis foto come from, Getty Images
Pancreatic cancer na cancer wey dem find anywhere for di pancreas.
Di pancreas na organ for di top part of di tumm wey dey It help digest food and make hormones like insulin.
How serious pancreatic cancer be dey depend on where e dey for di pancreas, how big e dey, if e don spread, and di pesin general health.
Wetin dey cause am Pancreatic cancer?
According to di UK NHS, anyone fit get pancreatic cancer. E no dey always clear wetin dey cause am.
You fit dey more likely to get am if you:
- Dey ova di age of 75, e no dey very common for pipo under under 40
- If you get certain medical conditions, like long-term chronic pancreatitis
- History of pancreatic cancer dey your family
- Many pancreatic cancers also dey linked to pesin lifestyle.
Symptoms of Pancreatic cancer
Pancreatic cancer fit no get any symptoms, or e fit dey hard to spot.
However common symptoms of pancreatic caner fit include:
- stomach and back ache
- unexplain weight loss
- indigestion
- changes to bowel habits, including floating faeces
Oda symptoms include:
- loss of appetite
- jaundice (yellow skin or eyes or itchy skin)
- diarrhoea or constipation, or oda changes for poo
- feeling and being sick
- difficulty to swallow
- recently diagnose diabetes
Dis informate come from di UK NHS












