Dengue fever outbreak in Ghana - Wetin we know

mosquito

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Ghana health service confam nine cases of dengue fever for di eastern region of di kontri

Di Ghana health service don confam di outbreak of dengue fever for di kontri.

So far nine cases don dey confamd as di health service tok say dem dey “manage dem as caseswey no serious for house.”

For one statement, di health service tok say dem find dis cases for di eastern region of di kontri wia dem treat dem for malaria symptoms but dem neva respond bifor dem carry dia samples go lab for testing.

“Afta Noguchi Memorial institute for medical research don do dia test, dey comfam say nine of di cases na dengue fever.”

Since dis development, di health service don “deploy pipo from di national level to join di regional team to carry out detailed outbreak investigation.”

Dis outbreak for Ghana don happun seven months afta Nigeria record cases of di fever.

Di world health organization (WHO) tok say since dem don record ova 5 million dengue fever cases since di beginning of 2023, wit ova five thousand deaths for 80 kontris, wia some dey Africa.

WHO tok say Africa bin dey part of di top four regions wia diseases like yellow fever, dengue and zika dey happun.

For di continent, kontris don record 171,991 dengue cases wit 753 deaths.

For dat year, kontris like Benin, Mali, Cote D’ivoire, Burkina Faso, Senegal and Togo don get cases.

Oda kontris like Cape Verde, Guinea, Chad together wit Ghana record cases.

MOSQUITO

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo gatz avoid mosquito bite wia dey for use repellent and sleep under treated nets - GHS

Wetin be dengue fever

Dengue fever na viral infection wia mosquito dey spread to pipo – specifically di aedes mosquito.

Most pipo wey get dengue fever neva dey show any signs but for pipo wia show signs, di most common ones na high fever, headache, body ache, nausea and rashes.

According to di Ghana heath service, most pipo go get beta between 1-2 weeks.

“Some pipo wey get severe dengue wia include bleeding, dis pipo don dem need hospital care.”

For serious cases, dengue fever dey fatal.

Which measures Ghana don take

Di health service tok say dey don do meeting ova say make dey set up national emergency operation center.

Di health service also carry alert to all regions and districts for di kontri so say dem go do surveillance to detect di cases early - wia dem sensitize health staff to do education.

According to di health service, dem don also begin “enhanced surveillance as dem dey do public education about di symptoms and how to prevent di disease.”

For treatment of dengue fever, na mainly “supportive care wit re-hydration (to drink plenti water), pain relief among odas.”

How to prevent dengue fever

Pesin gatz to avoid and prevent mosquito bite.

“Di mosquito wia dey transmit dengue fever dey bite pesin during di day, na so pipo gatz to protect diaserf,” Ghana health service warn.

As a result, dem dey tok say make pipo wear full sleeve cloth and long sleeve shirt to cover di legs.

Dem also dey advise make pipo use mosquito repellent.

“Pipi gatz to use insecticide treated nets - to protect babies, old pipo and odas during di day.”

For areas wia got drains and gutters, pipo for cover dem and for di home, dem tok say make remove objects wia dey collect water for house.

Di health service warn say make pipo neva do self-medication as dem collaborate to manage di outbreak.