Why court sama Peter Obi campaign DG Okupe two years jail term

Wia dis foto come from, Other
One Federal High Court for Abuja on Monday sama di Director-General of di Peter Obi Presidential Campaign Doyin Okupe two years in prison for money laundering.
E chop di two years imprisonment on count 34 with option of a fine of N500,000
Justice Ijeoma Ojukwu wey preside over di case wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) file bin earlier convict Okupe after she find am guilty of receiving over N200 million cash from former National Security Adviser (NSA) Col. Sambo Dasuki.
She say Okupe contravene sections Money Laundering Act.
Di court also sentence am to two years imprisonment on counts 35 to 59 with option fine of N500,000 - di option of fine go run consecutively on each count while di sentence go run concurrently.
Di sentence go run from di day of delivering di judgment.
Justice Ojukwu also give Okupe till 4:30 pm before dem take am into custody.
Wetin be Okupe offence
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin arraign Oga Okupe for 2019 on a 59-count charge bordering on alleged money laundering and diversion of N702 million - wey contravene sections 16(1)&(2) of di Money Laundering Act and accepting cash in excess of di threshold wey dey allowed under di Act without going through one financial institution.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Act provide say no individual or organization shall receive any sum wey dey above N5 million and N10 million respectively without passing through a financial institution alias bank - di judge come hold say “no evidence dey say di money pass through a financial institution”.
Justice Ojukwu say, di NSA no be financial institution, and say even if na di president wey authorize di funds, e no go fit say di money gatz be paid in cash in violation of money laundering.
Di court come hold say di first defendant wey be Oga Okupe dey guilty in counts 34, 35, 36 59.
Justice Ojukwu however find all di defendants for di case not guilty in counts 1 to 33 on di grounds say di prosecution bin fail to establish di charge of money laundering and criminal breach of trust and corruption against di NSA.
For counts 34 to 59 wey dem convict Oga Okupe for, e bin chop accuse say im receive various sums ranging from N10 million on different occasions from 2012 to 2015 wen e be SSA to President Goodluck Jonathan.
Oga Okupe bin tok say e bin spend di money on running di office, payment of staff, and image laundering of di former president and imadministration.
Doyin Okupe profile
Doyin Okupe na Nigerian Medical doctor and politician.
Na 22nd March, 1952 dem born am.
Im be di co-founder of Royal Cross Medical Centre and na former National Publicity Secretary of National Republican Convention (NRC).
Im bin don chop detention before under Former Military Head of State, General Sani Abacha for October 1996.
Im also be former govnorship aspirant of di People Democratic Party (PDP) for Ogun State, Southwest, Nigeria for 2002.
Doyin Okupe na former Senior Special Assistant for Public Affairs to former President Goodluck Jonathan.
Im be di Director General, Obi-Datti Campaign Organisation and e join di party sake of di 2023 general elections.
Im be di ‘stand-in vice presidential candidate of Labour party before dem announce Datti as di main Vice presidential candidate.
Im bin don work wit oda politicians like former Senate President Bukola Saraki and currect PDP Presidential candidate Atiku Abubakar.












