Ghana draw with Sudan for di 2025 Afcon qualifier

Photo of two players, one from Ghana one from sudan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis game bin dey veri important for Ghana as dem bin dey search of dia first win for di 2025 Afcon qualifiers
Read am in 3 mins

Ghana and Sudan play goalless draw for match day three of di 2025 Africa Cup of Nations qualifier.

Di match wey no too get action like dat see di two sides collect four yellow cards in total.

Pipo bin dey expect say Ghana go beat Sudan for house but e no happun like dat.

Westham star Mohammed Kudus captain di Black Stars of Ghana for dia crucial 2025 Afcon qualifier but beta result no come out.

Di Black Stars dey under serious pressure afta dem secure only one point from 2 games vs Angola and Niger inside group F.

Now, dem don share points with Sudan again as dem play goalless draw.

Ghana still dey third for Group F with two points afta three matches.

Angola and Sudan dey first and second; and Niger still dey bottom of di table.

As e be for Group F, Angola dey top wit 6 points; Sudan get 4 points, Ghana get 2 points and Niger dey bottom and fourth on di table wit only one point from two games.

photo of James Kwasi Appiah

Wia dis foto come from, SUDAN FOOTBALL ASSOCIATION/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Sudan head coach na former blackstars player and coach

One of di reasons di match bin important na sake of di Black Stars dey face Sudan at a time wey di coach of di falcons na former Black Stars player and coach wia im name be James Kwasi Appiah.

Appiah bin coach di Black Stars in 2012, wey im qualify dem to di 2014 World Cup.

In 2014, di Ghana football association give am two-year contract bifor im leave di team later in September dat year by mutual consent.

Appiah afta im leave di Black Stars bin coach Sudanese club Al Khartoum for December 2014.

But for April 2017, di GFA don appoint am again to coach di Black Stars afta dem sack Avram Grant.

Na so im supervise di black stars to qualify for dia next Afcon in 2019.

But for dat tournament in Egypt, Ghana comot di round of 16 stage; wey di GFA tok say dem no go extend im contract.

Photo of Kudus and other players

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ghana coach Otto Addo bin confam say Westham star Mohammed Kudus go captain di Black Stars vs Sudan

In September 2023, di Sudan football federation appoint Kwasi Appiah as di head coach of di team.

So James Kwasi Appiah na pesin wey sabi di Ghana national team well well.

Ghana coach Otto Addon tok for September say im no fit wish Kwasi Appiah di best for dis game.

“We all sabi Kwasi Appiah, na great pesin and good coach, I dey like am,” Otto Addo tok for one CAF seminar."

Im add say “normally, I go wish am well but for dis time, I no fit do dat sake of im dey play against us.”

pitchside view of the accra sports stadium
Wetin we call dis foto, CAF don give Ghana temporary approval to use di Accra sports stadium for dis game afta dey ban Ghana from hosting international games sake of di pitches no dey standard