Saif al-Islam, Muammar Gaddafi son die after one 'four man commando' unit shoot am according to reports

Saif al-Islam Gaddafi pictured in 2011

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Saif al-Islam Gaddafi's sister told Libyan media he had died near the Libya-Algeria border
    • Author, Nick Springate & Maia Davies
  • Read am in 4 mins

Saif al-Islam Gaddafi, son of Libya former leader Col Muammar Gaddafi, don die after dem shoot am according to reports.

Di news of di death of di 53-year-old, wey pipo bin reason as im father heir bin dey confirmed by di head of im political team on Tuesday, according to di Libyan News Agency.

Im lawyer tell AFP news agency say na one "four-man commando" unit carry out di assassination for im home for di city of Zintan, though e no dey clear who fit dey behind di attack.

Meanwhile for anoda version of events, im sister tell Libyan TV say e die near di country border with Algeria.

Saif al-Islam Gaddafi don dey seen for long now as di most influential and feared figure for di country after im father, wey rule Libya from 1969 until dem remove and kill am during one uprising for 2011.

Dem born am for 1972, e play a key role for Libya rapprochement with di West from 2000 until di collapse of di Gaddafi regime.

After im father removal, one rival militia jail Saif al-Islam Gaddafi - wey dem accuse of playing a key role for di brutal repression of anti-government protests - for di city of Zintan for almost six years.

Di International Criminal Court bin wan put am on trial for crimes against humanity for im alleged role in di suppression of opposition protests in 2011.

For 2015, dem give am a death sentence in absentia for im role in di crackdown by one court for Tripoli, in di west of di country, where control dey in di hands of di UN-backed govment.

But di militia release am for Tobruk, for di east, under one amnesty law two years later.

Since di overthrow of Gaddafi, Libya don dey divided into areas controlled by various militias and dey currently divided between two rival govments.

During im father time as leader, e shape policy and lead high-profile negotiations despite say e no get official role for govment, including those wia e lead im father to abandon im nuclear weapons programme.

Such agreements cause make dem lift international sanctions on di north African country and some consider Gaddafi to be a reformist and acceptable face of a changing Libya.

Gaddafi bin don always deny say e bin wan inherit power from im father, saying di reins of power no be "farm to inherit".

However, for 2021 e bin announce say e go run for di presidency inside elections wey dem later postpone indefinitely.

Who be Saif al-Islam Muammar Gaddafi?

Saif al-Islam Gaddafi wey dem born on 25 June 1972 and wey die on 3 February 2026, bin be Libyan political figure. Na di second son of late Libyan leader Muammar Gaddafi.

Since 2011, e bin dey stay for Zintan - first for prison, den from 2017 as free man wey dey plan how to return to politics.

Bifor di 2011 uprising, many pipo see am as di person wey go succeed im papa and di second most powerful man for Libya.

E remain important figure during di violence wey scatter Libya afta di Arab Spring protests, wey later turn civil war.

Plenty accusations come out against am say e involve for torture and serious violence against pipo wey oppose im papa govment.

By February 2011, United Nations put am for sanctions list and ban am from travelling.

For March 2011, NATO begin bomb Libya afta UN approve "all necessary measures" to protect civilians from Gaddafi forces during di civil war.

For June 2011, Saif al-Islam announce say im papa ready to conduct elections and step down if he no win. But NATO reject di offer and di bombing continue.

By end of June, International Criminal Court (ICC) issue arrest warrant for am, but e remain on di run until afta dem kill im papa and im broda Mutassim for Sirte on 20 October 2011.

For July 2015, one Libya court sentence Saif al-Islam Gaddafi and eight others to death over war crimes connected to di 2011 revolution.

More dan 30 close associates of Col Gaddafi face trial for suppressing peaceful protests during di uprising. Saif al-Islam no show for court but e don appear bifor through video link.

Dat time, na former rebel group from Zintan hold am and dem refuse to hand am over.

Di years bifor di uprising, Saif al-Islam bin dey try introduce political and economic reforms.

But wen pipo begin demand make im papa leave power - e stand wit am till di very end.