How husband, wife and dia children die afta dem chop cassava and millet swallow

Mama of di pikin wey die sake of suspected food poisoning

Wia dis foto come from, Dandare Family

Wetin we call dis foto, Mama of di pikin wey die sake of suspected food poisoning
    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
  • Read am in 3 mins

Six members of one family don die after di family of 10 bin chop food finish for Shagari local goment wey dey for Sokoto, Nigeria.

Di residents of di village wey im name na Naman Goma, tell BBC Pidgin say di family dem bin sick since on Thursday afta dem eat cassava and millet swallow wey dem combine togeda wey dem dey eat as always.

Abdullahi Dandare wey be broda to di papa of di pikin, tell BBC Pidgin say afta dem see dem in critical condition, dey come take dem to hospital

Dandare tok say, "na on Friday we decide to take dem go hospital sake of say dem dey in critical condition "

House of di deceased for Naman Goma village
Wetin we call dis foto, House of di deceased for Naman Goma village

E add say, "wen we dey on di way, one of di pikin come die, afta we reach di hospital di mama of di pikin dem come die too."

"Again two pikin die afta di mama pass away".

Dandare say dia papa dey among pipo wey prepare funeral prayer for im five family members.

Foto of di pot wey dem cook di swallow inside
Wetin we call dis foto, Di family bin fall sick afta dem eat cassava and millet swallow wey dem combine togeda wey dem dey eat as always.

"Afta we do di funeral with di papa, we notice say im body no strong and na im make us take am go hospital, den today in di morning, e come pass away."

Dandare add say "Di remaining four pikin dey for hospital dey receive treatment for food poisoning."

Foto of di plates wey dem use chop di swallow
Wetin we call dis foto, Foto of di plates wey dem use chop di swallow

One of di deceased neighbour wey im name be Abdullahi tell BBC Pidgin say di family dey veri peaceful in di village.

"I be neighbour to dis family for years and we neva get any issue wit dem, dem dey veri peaceful."

Di district head of di village Naman Goga say wen di mata happun, im no dey for di village.

E also tok say e know di family as peaceful wey live wit evribodi in di village witout any wahala.

Di ministry for health for Sokoto say dem dey on di mata as investigation dey still on, to find wetin happun.

Naman Goma village wey di incident happun

Wia dis foto come from, BBC

Wetin we call dis foto, Naman Goma village wia di incident happun dey for Shagari local goment for Sokoto, Nigeria.