Ifeanyi Adeleke beautiful moments and how e capture di hearts of many

Chioma and Ifeanyi

Wia dis foto come from, @THECHEFCHI @DAVIDO/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Chioma Rowland and Ifeanyi Adeleke
    • Author, Tunde Ososanya
    • Role, Broadcast Journalist

Nigerians dey currently mourn di death of Ifeanyi Adeleke wey be di son of ogbonge musician David Adeleke aka Davido and Chioma Rowland wey be celebrity chef.

Di three-year-old pikin drown yesterday for inside pool wey dey Davido house for Banana Island, Lagos, southwest Nigeria.

Apart from Davido fans and oda music lovers, celebrities and politician follow join di mourning and dis one show say Ifeanyi dey loved by many pipo.

'Ifeanyi Adeleke death be national tragedy'

Ifeanyi wey celebrate im three years old birthday for 20 October, 2020, na di darling of millions sake of di kind pesin wey im papa be.

Ifeanyi papa, Davido, na pesin wey dey help pipo wey dey in need and im don assist a lot of upcoming artistes and celebrities. Di help wey Davido dey render to pipo na im give birth to im phrase "we rise by lifting odas".

Sake of Davido good heart and influence for di music industry, many pipo extend di love wey dem get for am to im pikin Ifeanyi, wey be carbon copy of Chioma.

Apart from di fact say Davido dey help pipo, Davido dey always put mouth for mata of public concern and e no dey hide how e feel about certain issues wey concern pipo.

Davido na one of di most successful musicians for Nigeria and im popularity for di kontri and outside di kontri also make pipo both ordinary pipo, entertainers and politicians to condole wit am sake of Ifeanyi death.

Some of di politicians wey follow send condolences na Govnor Ifeanyi Okowa of Delta State, Labour Party presidential candidate Peter Obi, All Progressives Congress presidential candidate Bola Ahmed Tinubu, and Peoples Democratic Party presidential candidate Atiku Abubakar.

Di death of Ifeanyi touch millions of pipo wey don follow di love tori of im mama and papa - Davido and Chioma - from di beginning to wen dem get im belle born am and wen e begin dey grow.

Some Ifeanyi Adeleke beautiful moments

Ifeanyi Adeleke wey be Davido first son na happy pikin wey dey always light up social media wit im pictures and videos anytime im papa or mama post dem online.

Di pikin get im own Instagram page wey im papa and mama dey help am handle, but some of di beautiful moments wey im share with im parents dey documented on Davido and Chioma social media pages.

Better Time album cova

Davido release im Better Time album for 2020 and na Ifeanyi Adeleke dey di album cova.

For inside di album cova, Ifeanyi wear diapers and dey crawl for ground.

Inside di caption of di foto wey Davido share, im say: "I no go keep you any longer. Dis year we don go through crazy times. Real crazy times. And through it all, all of us gaz look inwards to find our unique hopes of better times ahead. I find some. For human form and creative form. I dey glad say I fit finally share dem wit you. I present to you ‘A Better Time’ out 13/11/20 00:00 WAT !"

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Chioma dey feed her 'little man'

Chioma bin share one mother-son moment video on her Instagram page wia she dey feed Ifeanyi as both of dem dey listen to 'One Thing' by Davido - one of di tracks inside di Good Time album.

Di little man dey move im leg as im mama dey feed am and Chioma tok for inside di caption of di video say Ifeanyi na lover of music.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

Lovely mother-son moments

Ifeanyi and im mama light up social media wit two fotos wey Chioma post on her Instagram page wia she tok say anytime wey she open her mouth Ifeanyi dey always try open am to look for wetin she dey chop.

Inside one of di fotos wey Chioma share, di look on Ifeanyi face na of surprise as im open im mouth and strain im eyes as both mama and pikin pose for di camera.

Skip Instagram post, 3
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 3

Ifeanyi 2nd birthday

For 20 October, 2021, Davido enta Instagram to wish im son Ifeanyi happy 2nd birthday as im share one foto of di boy wearing Yoruba attire.

Ifeanyi look into di camera as di cap sit ontop im head as e show di world say im be correct Yoruba boy from Osun State, southwest Nigeria.

Davido profess im love for Ifeanyi and pray say di boy go live to become great pesin more dan im.

Skip Instagram post, 4
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 4

'Happy Feet'

Davido nickname im son 'Happy Feet' as im share video of di boy dey run with am inside dia compound.

Inside di caption, Davido tell Olympics say im son dey come as e add say di boy na future medalist.

Skip Instagram post, 5
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 5

'Energetic boy'

For inside one video wey Davido share for im Instagram page, Ifeanyi bin dey dance to Enjoy by Nigerian artiste Tekno on di eve of im 3rd birthday.

Di boy enta di dance floor and begin display dance moves wey make di adults wey dey around burst into laughter.

As di adult begin laugh, Ifeanyi begin shy and stop to dey dance.

Skip Instagram post, 6
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 6

Ifeanyi 3rd birthday

Fotos of Ifeanyi 3rd birthday light up social media on 20 October 2022.

Both Davido and Chioma enta dia social media pages to celebrate dia son as im clock new age.

"I pray wit all my heart say go God grant you perfect health and pure happiness for as long as e dey humanly possible. You go grow to dey greater dan Me , Happy birthday, son," Davido caption di post.

Skip Instagram post, 7
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 7