Arsenal dominate Leeds to remain top of Premier League

Gabriel Jesus score twice for Arsenal win agaisnt Leeds

Wia dis foto come from, Getty Images

Arsenal don maintain dia firm grip of for di top of di Premier League.

Di Gunners beat Leeds United 4-1 for di Emirate Stadium wit two goals by Brazilian forward Gabriel Jesus.

Leeds’ Rasmus Kristensen pull one back for di 76mins before Ben White and Xhaka score di third and final goals of di day.

Arsenal show a lot of maturity for di game wit di way dem control dia sef knowing say Manchester City dey behind dem.

City bin win dia early game on Saturday wit a 4-1 victory against a poor Liverpool side.

While Arsenal get games to play, Man City get to play 10 games – dem get one outstanding match.

On di league table Arsenal dey lead wit eight points.

Second Half

90+5mins: Final Whistle

90+1: YELLOW CARD. Patrick Bamford wey just enta chop card.

90mins: 4mins of added time.

89mins: Linesman raise flag against Arsenal forward

86mins: SUBSTITUTION. Jack Harrison comot for Patrick Bamford to enta

85mins: SUBSTITUTION. Emile Smith Rowe enta for Martin Odegaard. Kieran Tierney for Oleksandr Zinchenko and Fabio Vieira Xhaka

Arsenal 4-1 Leeds

85mins: GOAL! Granit Xhaka

82mins: Granit Xhaka send high cross into di box. Leeds defender clear am.

81mins: Gabriel Martinelli get caution for a foul.

Arsenal 3-1 Leeds

76mins: GOAL! Rasmus Kristensen pull one back for Leeds.

75mins: SUBSTITUTION. Liam Cooper enta for Robin Koch. Georginio Rutter replace Crysencio Summerville.

74mins: Leandro Trossard fail to find any of im teammates inside di box.

71mins: Weston McKennie bring im opponent down and Darren England interrupt di game.

68mins: Darren England caution Ben White afta foul on Leeds forward.

66mins: SUBSTITUTION. Rodrigo enta for Luis Sinisterra. Weston McKennie replace Brenden Aaronson

65mins: Rasmus Kristensen miss as im shot go over di bar.

61mins: SUBSTITUTION. Bukayo Saka replace Gabriel Jesus. Jorginho enta for Partey

60mins: Gabriel Martinelli beat im marker but di attack o end well

Arsenal 3-0 Leeds

55mins: GOAL! Gabriel Jesus courtesy of pass from Leandro Trossard

53mins: Brenden Aaronson send in a lofted cross from a mid-range free kick, but im poor effort go out of play.

52mins: Luis Sinisterra commit foul and Darren England immediately signal free kick.

Arsenal 2-0 Leeds

47mins: GOAL! Ben White make am two for Arsenal. Good pass from Martinelli

47mins: Ref catch Gabriel Jesus offside.

45mins: Second Half don start

Arsenal vs Leeds, Live updates

Wia dis foto come from, Getty Images

First Half

Arsenal 1-0 Leeds

45+5: Half Time

45+1: YELLOW CARD. Robin Koch chop card for rough tackle on Martinelli

45mins: 3mins of added time.

44mins: Game don stop sake of injury on Martin Odegaard

41mins: Marc Roca put cross into di box from di free kick, but di defender first reach dia.

39mins: Martin Odegaard find im sef free inside di box and pull di trigger, but dem stop im effort.

Arsenal 1-0 Leeds

35mins: GOAL! Gabriel Jesus score for Arsenal

33mins: Poor challenge! Luke Ayling rough challenge on Jesus. Penalty for Arsenal.

30mins: Crysencio Summerville run onto di ball inside di box and smash better shot towards di bottom right corner.

26mins: Arsenal players dey display brilliant short passes and great ball movement. Dem dey wait to open di opposition defence and hit dem on di break.

22mins: Crysencio Summerville get great chance inside di six-yard box, e shoot low to di middle of di goal, but Aaron Ramsdale pull off good save to deny am.

21mins: Jack Harrison bring im opponent down.

18mins: Martin Odegaard cross di ball from di free kick, but e go out of play.

14mins: Trossard dey cover for Saka wing. E never blend well into di role.

12mins: Aaronson play good cross into Arsnal 18 from a freekick. No Leeds play dey available to convert am.

10mins: MISSED CHANCE. Jesus miss scoring opporunity.

7mins: Zinchenko try to locate Martinelli wit a pass. E too high

5mins: Leeds bin dey look to break from Summerville but di defenders stop am.

3mins: Granit Xhaka bin pick up injury. But e be like e go fit continue

Arsenal 0-0 Leeds

1min: Game don start

Arsenal vs Leeds Line ups

Arsenal: Ramsdale, White, Holding, Gabriel, Zinchenko, Ødegaard, Partey, Xhaka, Trossard, Gabriel Jesus, Martinelli.

Leeds: Meslier, Ayling, Koch, Kristensen, Struijk, Firpo, Summerville, Roca, Aaronson, Harrison, Sinisterra