She see herself for porn site as di actress, but na fake

Wia dis foto come from, Getty Images
"Jodie" bin see video of herself for inside deepfake porn - but she come get anoda big shock: di pesin wey dey responsible for di video na one of her best friends.
WARNING: Dis story contain offensive language and descriptions of sexual violence
For spring of 2021, Jodie (not her real name) bin receive a link to one porn website from one anonymous email account.
As she click on di link, she see explicit images and one video of pesin wey be like her as she dey have sex wit plenti men. Dem carry Jodie face and digitally put am for anoda woman bodi - dem dey call am "deepfake".
Sombodi bin post fotos of Jodie face for one porn site and tok say she dey make am feel "so horny" and ask if odas users for di site fit make fake pornography of her. Di pesi promise to share more fotos of Jodie and details about her.
Speaking for di first time about her experience, Jodie, wey dey her mid-20s now, tok say, "I just dey scream, dey cry and I dey scroll through my phone to wetin I dey read and wetin I dey look."
"I know say dis video fit scata my life."
As she dey force herself to scroll through di porn site, Jodie tok say she feel her "whole world fall away".
End of Di one wey oda users dey read well well
Na wen she see one particular image, na dat time she make a horrible realisation.
Dis no be di first time dem go dey target Jodie.
In fact, dis na di high point of plenti abuse wey anonymous pipo don dey abuse her online.
Wen Jodie be teenager, she discover say pipo dey use her name and fotos for dating apps witout her consent.
E continue like dis for years, and she even receive one Facebook message from one stranger for 2019 wey tok say im wan meet wit her for Liverpool Street station for London for a date.
She tell di man say she no be di pesin wey bin dey follow am tok. Jodie tok say di tin shock am as di man know evritin about her and manage to find her online. Di man find her Facebook handle afta di "Jodie" for di dating app stop to dey respond to am.
For May 2020, for inside di UK lockdown, one of Jodie friends alert her say e get Twitter accounts wey dey post pictures of her wit captions implying say she be sex worker.
"Wetin you go like to do wit little teen Jodie?" na one of di caption wey dem write on top one image of Jodie as she wear bikini. Di picture na from her private social media account.
Di Twitter handles wey dey post di fotos get names like "slut exposer," and "chief perv."
All di images wey dem dey use na fotos wey Jodie been don share on her social media wit her close friends and family - but no one else.
She later find out say di accounts dey also post images of oda women wey she know from university, as well as from her hometown of Cambridge.
"In dat moment, I feel a veri strong sense say na me dey di centre of dis and dis pesin dey look to hurt me," she tok.
Fighting back
Jodie begin to dey contact di oda women in di pictures to warn dem, including anoda close friend wey we go call Daisy.
"I just feel sick," Daisy tok.
Togeda, di friends discova many oda Twitter accounts wey dey post dia images.
"Di more we dey look, e dey get worse," Daisy tok.
She send message to di Twitter users and ask dem wia dem get dia pictures. Dem reply say di fotos na "submissions" from anonymous senders who want make dem share am.
"E fit be one ex or pesin wey wan do you back," one of di users reply.
Daisy and Jodie do a list of all di men wey dey follow both of dem for social media, and wey fit access both sets of dia pictures.
Di friends later conclude say e go be Jodie ex-boyfriend. Jodie confront di guy and block am.
For a few months, di posts stop - but later one anonymous pesin send Jodie email.
"Sorry to remain anonymous," di email tok, "but I bin see dis guy wey dey post your pictures on creepy subreddits. I know say dis go dey really scary."

Jodie click on di link and e take am to Reddit, where one pesin post fotos of Jodie and two of her friends, numbering dem 1, 2 and 3.
Di post dey invite pipo to take part in one game - which of dis women you go like have sex wit, marry or kill.
Fifty-five pipo don already comment for under di post.
Di fotos wey dem post for dat site dey recent, and dem post dem afta Jodie block her ex. Na dat time di women realise say dem don blame di wrong pesin.
Six weeks later, di same emailer send anoda email - dis time na about di deepfakes.
'Di ultimate betrayal'
Wen dem dey draw up dia list, Jodie and Daisy bin rule out some men wey dem completely trust, such as family - and Jodie best friend, Alex Woolf.
Jodie and Alex don be friends since dem be teenagers, and dia friendship become stronger as di two of dem love classical music.

Jodie bin don go to Woolf for comfort wen she discover say pipo dey use her name and fotos for dating apps witout her consent.
Woolf later get a double first for music from Cambridge University and win BBC Young Composer of the Year 2012, and also appear on Mastermind for 2021.
"Im [Woolf] dey veri aware of di issues wey women dey face, especially on di internet," Jodie tok.
"I bin really feel say im be advocate."
However, wen she see di deepfake porn fotos, e get one picture of her in profile wit di image of King's College, Cambridge, behind her.
She clearly remember di picture - and dat Woolf bin also dey for di foto. Im na di only oda pesin she bin don share di image wit.

Na Woolf bin dey share more original pictures of Jodie so dat dem go dey use am do deepfakes.
"E bin know di impact e dey get for my life well well, yet e still do am," Jodie tok.
'Utterly ashamed'
For August 2021, dem convict Woolf, 26, of taking images of 15 women, including Jodie, from social media and uploading dem for pornographic websites.
Dem give am a 20-week prison sentence, suspend am for two years and order am to pay each of im victims £100 in compensation.
Woolf tell di BBC say im dey "utterly ashamed" of im behaviour and e dey "deeply sorry" for im actions.
"I tink about di suffering I cause evri day, and I no get doubt dat I go dey do so for di rest of my life," e tok.
"I no get excuses for wetin I do, and I no fit adequately explain why I act on dis impulses so despicably for dat time."
Woolf deny say e get anytin to do wit di harassment of Jodie wey bin don happun bifor di events dem charge am wit.
For Jodie, to find out wetin her friend do her na di "ultimate betrayal and humiliation".
She tok say: "I dey re-live evri conversation wey we bin get, as im bin comfort me and support me and dey kind to me. All na lie."
We contact X, formerly Twitter, and Reddit about di posts. X no respond, but one tok-tok pesin from Reddit tok: "Non-consensual intimate media (NCIM) no get place on di Reddit platform. Di subreddit in question don dey banned." Dem don also take di porn site down.
For October 2023, sharing deepfake porn become a criminal offence as part of di Online Safety Bill.
E get tens of thousands of deepfake videos online. Recent research show say 98% of dem dey pornographic.
However, Jodie dey veri angry say di law no criminalise pesin wey ask odas to create deepfakes, wey be wetin Alex Woolf do. Also, e no dey illegal to create a deepfake.
"Dis dey affect thousands of women and gatz get di proper laws and tools in place to stop pipo from doing dis," she tok.
If you don dey affected by any of di issues for dis tori information and support dey available through di BBC Action Line













