Video: Zelensky vex comot White House after angry meeting with Trump wey tell am to 'come back wen you dey ready for peace'

Video: Zelensky vex comot White House after angry meeting with Trump wey tell am to 'come back wen you dey ready for peace'

US President Donald Trump and Ukraine President Volodymyr Zelensky clash during one angry meeting for di White House on Friday.

Trump tell im Ukrainian counterpart to dey "thankful" and accuse am of "gambling with World War Three".

Trump tell di Ukrainian president to "make a deal or we're out".

Zelensky say dey no suppose be "compromises" with Vladimir Putin - but Trump say Kyiv go need to bend to reach a peace deal with Russia.

Na ogbonge moment of tension.

Zelensky now don comot from di White House and one planned news conference with di two presidents don dey cancelled.

"E fit come back wen e dey ready for peace," Trump post ontop im Truth Social platform.

Dis dey happun one week after Zelensky say Trump dey "live in a disinformation space" wey Russia create, and Trump accuse Zelensky of being a "dictator".