'I hear di first gunshot for sleep' - Nigerians narrate dia experience for Sudan

Wia dis foto come from, NIDCOM
- Author, Tamara Ebiwei
- Role, Reporter, BBC News Pidgin
- Reporting from, Abuja
Di first batch of Nigerian students wey bin dey stranded for Sudan sake of di crisis dia don come back.
Dem land di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja around 11.30pm on Wednesday.
Dem land ontop di military jet C13 around 11:40 pm.
Na ova 300 Nigerians arrive on both di military jet and commercial airline AirPeace wey bin offer to go for di evacuation exercise.

Wia dis foto come from, NIDCOM
'I dey sleep wen I hear di first gunshot'
Arun Musa wey dey study Educational Administration for di International University of Africa tell BBC Pidgin say na im first time for Nigeria since five years.
E say 15 April, 2023 na day wey im no go fit forget for im lifetime.
Im say im bin dey sleep wen im hear di first gunshot.
"Actually, I bin dey sleep on di 15th of April 2023, I just hear gunshot and bomb near my surroundings. I just get up from bed in shock, I begin see animals dey run from every corner, we humans too begin run, na only short nika I wear wit singlet. We begin run but we no know wia we dey go.
End of Di one wey oda users dey read well well
Our school try for us, na dem protect us .
Plenty tins dey to tok but I tank God say I don reunite wit my family and e sweet my belle." E tok.

Wia dis foto come from, NIDCOM
October 2023, for make Saratu Adam five years for Sudan. But di young Nigerian get to abandon her studies and run for safety wit only four months wey remain for her to graduate.
Saratu dey among oda girls and women wey no fit access beta personal hygiene becos of di crisis.
She tell BBC Pidgin say, to see food chop and drink water na big wahala for dem.
"Di water we dey drink no clean, we no even see beta food chop sake of say food to cost."
Anoda young girl tell BBC Pidgin say dem no see beta toilet and dia biggest fear na make dem no carry infection if dem survive, some of dem dey pregnant and dem need beta hygiene.
"Di experience dey traumatising for me, till now if I hear loud sound I dey fear, but e don master me small. We thank goment as dem bring us home" She tok.

Wia dis foto come from, NIDCOM
Wetin dey cause di katakata for Sudan
Di Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) fight for weeks now don kill ova 400 pipo.
Since di 2021 coup for Sudan, na council of generals wey two military men dey lead dey run Sudan.
Dis two military men na dem dey di centre of di crisis inside di kontri.
Gen Abdel Fattah al-Burhan, wey be di head of di armed forces and in effect di kontri president.
And im deputy and leader of di Rapid Support Forces (RSF) Gen Mohamed Hamdan Dagalo, wey dey known as Hemedti.
Two of dem disagree with each oda on di direction wey di kontri dey go and di planned move to bring civilian rule.
Di main issue na plans to include di 100,000-strong RSF into di army, and who go den lead di new force.
Gen Dagalo don bin tok say di 2021 coup na mistake and don try to present imsef and di RSF to show say dem dey di pipo side, against di Khartoum elites.
While e get some support, odas find dis message hard to believe sake of di paramilitary force wicked track record.
Meanwhile, Gen Burhan don bin tok say di army go only fully hand ova power to elected goment.
But suspicion dey ground say both military men, and dia supporters, dey worried about wetin fit happun to dia wealth and influence if dey remove dem from dia powerful positions.
So far, no Nigerian don die for di katakata as goment don tell parents to calm down say dem go do dia best to evacuate di students safely.

Wia dis foto come from, NIDCOM

Wia dis foto come from, NIDCOM















