'No cause for alarm' - NSA disclose wetin dem discuss wit Buhari for emergency security meeting

Wia dis foto come from, Buhari Sallahu
Di emergency security meeting wey Nigeria president, Muhammadu Buhari do wit di security chiefs don hold finish for Abuja, di nation capital.
Wen e dey speak wit tori pipo after di meeting di National Security Advisor, Babagana Monguno say no shaking make Nigerians put dia minds for ground.
President Buhari bin on Sunday 30 October summon one emergency meeting to discuss security mata wey dey worry di kontri pipo.
According to di tweet wey dey di verified handle of di Nigerian Presidency, di meeting na to further review and strengthen security network for di country.
'E dey irresponsible and false'

Wia dis foto come from, Buhari Sallahu
Di NSA, wey say di situation dey under control, described as false and irresponsible di perception of heightened insecurity for Abuja wey di UK and US goment bin paint.
Dis meeting come amidst series of security alerts from some foreign kontri over scare of terrorist atatck
Di United States of America, United Kingdom and some oda kontris bin ask dia cirizens wey dey stay for Nigeria to comot quick quick for dia own safety.
Monguno insist say di alert na for American and British citizens and dat di way dem release am complicate di situation.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say di alert na simply unnecessary distraction and nothing untoward so far.
Di NSA come advise Nigerians to go about dia daily activities without fear, saying dat di security agencies dey in full control. E add say Nigeria dey safe.

Wia dis foto come from, Buhari Sallahu
Security agencies bin earlier tok say dem dey ontop of di mata say make kontri pipo no worry but dey vigilant.
Security mata for Nigeria don dey somehow for many years wit cases of kidnapping on di rise across di kontri.
Wetin to know about di terror alert for Abuja
On 23 October, di United States of America issue security to dia her citizens for Nigeria say make dem avoid non-essential travels. Dem warn of possible terror attack for Nigeria capital Abuja.
United Kingdom - As dat one dey shele, United Kingdom also issue her own alert on 26 October.
Di United Kingdom Commonwealth and Development Office FCDO post for dia latest travel advisory for dia website say increased threat of terrorist attacks dey for Nigeria capital.
Dem warn dia pipo for Nigeria make dem avoid non essential travels to Abuja.
Dem also name other states wey dey include for di terror alert list. Dem include Bauchi, Kano, Jigawa, Niger, Sokoto, Kogi, Abia, Plateau, Taraba.
Germany for dia own latest travel advisory on October 27 tell her kontri pipo make dem avoid non-essential travels to Abuja. Dem aay make dem avoid crowds and busy public places.
Ireland - Department of Foreign Affairs for travel alert dem issue on October 24 for dia website warn citizens for Abuja to review dia personal security.
Dem add say make dem dey alert and avoid gatherings plus all non essential movements within Abuja.Dem also wan dia pipo make dem avoid travels to some states within Nigeria














