Video show moment bifor di deadly South Korea plane crash wey claim 179 lives
Video show moment bifor di deadly South Korea plane crash wey claim 179 lives
One video capture di moments bifor a plane wey bin dey carry 181 pipo crash while landing for one airport for South Korea.
Di Boeing 737-800 flight - wey bin dey operated by Jeju Air - bin dey arrive at Muan Airport from Bangkok, Thailand.
Dem pull out two surviving crew members from di debris and take dem to di hospital.
Footage also show di huge emergency services operation - na more dan 1,500 personnel authorities deploy to di recovery operation.



