GFA confam say dem rescue Christian Atsu from under Turkey earthquake rubble

Christian Atsu

Wia dis foto come from, Christian Atsu/Twittter

Latest reports from Turkey dis morning be say dem don pull Christian Atsu from de wreckage of di earthquake alive.

Ghana Football Association, GFA tok for tweet say dem receive some positive news say Christian Atsu don dey successfully rescued from di rubble of di collapsed building and dey receive treatment.

Turkish journalist, Yagiz Sabouncouglu bin earlier reveal dis on en Twitter handle.

Dis confirmation dey come from de Turkish sports journalist despite say e initially debunk claims say dem rescue Atsu.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

According to Yagiz, dem carry Atsu go hospital for treatment sake of e get injuries.

Inside tweet wey e share e write, “Hatayspor Manager Mustafa Özat: I just had anoda meeting. Dem carry Christian Atsu go hospital with injuries.”

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Sporting world bin call for prayers tori break say Atsu bin trap.

Ghana president Nana Akufo-Addo join many Ghanaians all over de world to pray for di safety of Christian Atsu.

President Akufo-Addo for statement wey e release also commiserate wit di govents of Turjey and Syria for de disaster.

“On behalf of di govment and people of Ghana, I extend heartfelt condolences to de govments and peoples of Turkey and Syria on de devastation and de tragic loss of lives Monday’s earthquake cause. May their souls rest in perfect peace.

“Our hearts and prayers go out to de survivors, and we pray dat say make dem see our fellow Ghanaian, Christian Atsu.

Di Ghana Football Association also tell fans to "pray" for former Chelsea and Newcastle forward Christian Atsu – wey tori tok say dey trapped under rubble for di earthquakes in Turkey.