How fans react to 19-year-old Millie Bobby Brown engagement announcement

Wia dis foto come from, Getty Images
Fans don dey react to di engagement announcement of British actress Millie Bobby Brown to co-actor Jake Bongiovi.
Di 19-year-old 'Stranger Things' star bin announce her engagement to her boyfriend of two-and-a-half years, on Instagram.
While some of di fans worry say she too young to dey engaged, say she still be pikin, while odas congratulate her.
Di 19-year-old 'Stranger Things' star wey post foto of herself wit Bongiovi on Instagram say: "I don love you three summers now, honey, I want 'em all."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di star bin show off her engagement ring as she add white love heart emoji to di end of her post.
Her fiancé, 20-year-old Bongiovi, na actor and son of legendary singer, Jon Bon Jovi.
Bongiovi also share di news on im own page, e simply write "forever" alongside two fotos of di couple.
Brown statement bin reference di lyrics from Taylor Swift track Lover, wey she take from her seventh studio album of di same name.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di announcement dey come weeks afta tori bin spread on social media say di coule don engage.
Brown bin introduce Bongiovi to her followers for June 2021 wit one of im foto wey she post on Instagram. Di pair later confam say dem be couple.
For inside anoda post on Instagram wey she post for January, Brown bin call Bongiovi her "partner for life" and post some of dia fotos togeda.
Di English actress bin rise to fame as a child star on di smash hit Netflix series Stranger Things, di forthcoming season five go be di show last season.
Bongiovi recently land im second major acting role for one new coming-of-age film Rockbottom.

Wia dis foto come from, Getty Images
Who be Millie Bobby Brown?
Brown become household name afta she feature as di protagonist for one Netflix series – 'Stranger Things.'
Dem born her for 19 February 2004 for Marbella, Spain. She rise to fame sake of her role as Eleven for di series wey gbab her Primetime Emmy Award nomination for Outstanding Supporting Actress for Drama series at age 13.
At di age of 14, fake news about her bin spread for social media wey make her quit Twitter sake of di harassment.
For 2018, she feature for di Time 100 list of di world influential pipo,. She be di first youngest pesin to feature for di magazine.
She win di Screen Actors Guild Award for Outstanding Performance for one Drama Series wit her co-stars.
For January 2018, Brown na di star of di film adaptation of di Enola Holmes Mysteries book.
Who be Jake Bongiovi ?
Bongiovi na one of Bon Jovi rocker Jon Bon Jovi four children, wey e get wit im wife Dorothea Hurley.
Dem born am for 7 May 2002 for New Jersey.
E be actor and dey popular for di movie Sweethearts.
Bongiovi recently land im second major acting role for one new coming-of-age film Rockbottom.
How fans react to di news of di engagement
Hashtag "she's 19" bin dey trend for Nigeria social media following di engagement announcement of Millie Brown.
Some of her fans receive di announcement wit joy as dem congratulate her, odas tink say she still dey too young to make dat kain lifetime decision.
Singer Pixie Lott dey among di stars wey don comment on Brown post, she write say: "Omg!!!! Congratulations you two so happy for you eeeee."

Wia dis foto come from, Screenshot

Wia dis foto come from, Screenshot

Wia dis foto come from, Screenshot

Wia dis foto come from, Screenshot













