Meet Lance Corporal Chloe: di dog wey dey help Ghana police fight crime

Lance Corporal Chloe
Wetin we call dis foto, Lance Corporal Chloe

Pesin go ask say wetin concern man about dog wey dey trend for social media?

Well, dis no be ordinary dog.

Dis na Ghana police service dogs wey dey help di kontri fight crime.

Last week, photo of one of di dogs begin dey trend.

Di dog wear police costume wit socks and leash wia one police man dey take am waka.

One popular social media influencer for Ghana, Nana Téa share di picture wit caption say “Chai.. dis na di most privileged dog for di kontri right now. Im dey wear socks.”

Na so pipo now dey share di photo, odas just dey comment for di post.

But wetin we know about dis dog and why e dey trend?

E be lance corporal Chloe.

One of 49 sniffer dogs wia dey for di K9 unit of di Ghana police service.

As you see am so, na proper trained dog.

Lance corporal Chloe den im oda colleagues don dey help di police carry out different tasks.

Di K9 unit get about five breeds.

Di unit get German shepherd, Belgian malinois and Rottweiler.

Di odas be coca spanion and Dutch shepherd.

Wetin be di duties of di sniffer dogs

One of di dogs for di K-9 unit

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Di dogs dey carry out detection of explosives and narcotics.

Some also dey fit detect money wey dem hide for inside luggage.

Lance Corporal Chloe and im colleagues also dey fit detect weapons for cars, houses or oda places.

Since di police don establish di K9 unit, di dogs don dey help for highway patrols.

Sometime in October 2021, di service deploy di dogs to various places for di kontri to increase visibility.

For one statement di police release dat time, dem tok say “di dogs dey help track contraband goods wey dey improve oda aspects of criminal investigations”.

For di last few months, di police don dey use di dogs to conduct searches for di airport and oda lorry stations.

Some of di dogs also dey help for controlling crowd.

Di ranks wey di dogs get

Ghana police officers with some of di dogs

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Wetin we call dis foto, Di service dey promote di dogs based on years of service and good conduct.

Just like e dey for normal police service, so also di ranking system dey for di sniffer dogs.

Di service dey promote dem based on years of service and good conduct.

LCpl Chloe don chop over four years for di service.

Odas among di 49 be corporals and sergeants.

Di ones wit di highest rank na Inspector Ragna and Inspector Hunter.

For di K9 unit, di pipo wey dey handle dis dogs na proper Ghana policemen and women wia dem train for South Africa.

Di Inspector General of Police, Dr George Akuffo Dampare tok say di unit be one area im never dey take am lightly.

According to di IGP, di way “criminals don make sophisticated, na so di police also dey upgrade to match dem boot-for-boot.”

Afta one operation di police dey call “who let di dog out” for 2021, wey allow di men and di dogs enter communities to enhance visibility and crime-fighting, di service say tins dey better.

Ghana Police parade di 49 dogs on 22 November as di 52nd cadet officers graduation wey happun for Accra

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Wetin we call dis foto, Ghana Police parade di 49 dogs on 22 November for di 52nd cadet officers graduation wey happun for Accra

Na so on 22 November for di 52nd cadet officers graduation wey happun for Accra, di police parade di 49 dogs.

For di IGP, dis na to show say di unit don dey firm to do dia work, especially as di festive season dey come wey plenti pipo go come di kontri for holidays.

LCcpl Chloe and im oda colleagues don dey ready whenever dia bosses go call dem.

Na dia duty be dat.