Appointment of Oshiomhole son and five tins Edo govnor Monday Okpebholo don do

Edo state Govnor Monday Okpebholo take im oath of office on Tuesday

Wia dis foto come from, Govnor Dapo Abiodun twitter

Read am in 5 mins

Edo State Govnor Monday Okpebholo don make some key appointments for im administration.

Some of di pipo Govnor Okpebholo pick wey go work wit am for key positions include State Attorney-General, Secretary to State Government and Health Commissioner-designate.

Fred Itua, di tok-tok pesin for di Govnor write for inside statement.

Dis appointment dey come afta Govnor Okpebholo take im oath of office on Tuesday.

Vice President Kashim Shettima bin lead di federal goment delegation wey attend di inauguration of Monday Okpebholo as the fifth democratically elected governor of Edo State.

Oda govnors elected under di platform of di All Progressives Congress join Oga Shettima.

APC govnors wey attend include Babajide Sanwo-Olu of Lagos, Dapo Abiodun of Ogun, Hope Uzodinma of Imo, and Ahmad Aliyu of Sokoto, among odas.

Di National Chairperson of di APC, Umar Ganduje, and im predecessor, Adams Oshiomhole, one senator from Edo, also attend di ceremony for Samuel Ogbemudia Stadium for Benin.

So who Okpebholo don name for key position?

Musa Ikhilor (SSG)

Govnor Monday Okpebholo nominate Musa Ikhilor as di secretary to di state goment.

Dem born Ikhilor for 6 August 1980, for University of Benin Teaching hospitalfor Benin.

Im attend Ahmadu Bello University, Zaria, wia im obtain im LL.B for 2008.

Oga Ikhilor get ova 11 years of experience for Legislative Drafting, Parliamentary Administration, Law-making procedure and processes, Constitutional drafting and amendment, and general Legislative Governance issues, im bin work for various capacities for National Assembly too.

For 2019, im bin collect appointment as a Consultant to di Federal House of Representatives of Nigeria on di review of di 1999 Constitution of kontri, wia im been closely analyse and review matters on Gender Equity, Human Rights, and strengthening Institutions of goment and create efficient and transparent processes and systems to deliver good Governance.

Oga Ikhilor dey active for Business, Corporate Legal Practice and social works wia im serve as di managing partner of Springfield Legal Consult and as di executive director & Board of trustees member of Amana Legacy Foundation. In addition to dis roles, im also provide consultancy services to several private and public sector entities.

Im dey married wit children.

Dr Cyril Adam Oshiomhole (Commissioner for Health)

Dr Cyril Adams Oshiomhole na di son of di former Govnor of Edo state Adams Oshiomhole.

Govnor Okpebholo nominate Dr Cyril Adams Oshiomhole as commissioner for health.

Dr Cyril Adams Oshiomhole na pesin wey school for Nigeria and outside di kontri.

But im academic journey start for St. Anne’s Primary School, followed by Command Secondary School, wia im later pursue im higher education for Ahmadu Bello University, Zaria, and earn im Bachelor’s degree for Medicine and Surgery (MBBS).

Oshiomhole also attend Tulane University School of Public Health and Tropical Medicine, New Orleans, LA. wia im obtain a Master of Science for Public Health (MSPH, im major in Environmental Health, Toxicology, and Disaster Management).

Im academic journey continue for Harvard University, Boston ,wia im do im postgraduate training for Clinical Research and for Queen Mary University, London, im study Gastroenterology.

Samson Osagie (Attorney General and Commissioner For Justice)

Dr. Samson Osagie, na im di govnor nominate for di Attorney General and Commissioner For Justice for state.

Di 57-year-old from Uhunmwode Local Government Area of Edo State get im call to Nigerian Bar for 22 March 1995.

Currently, na im be di vice president of di African Bar Association (West African Region).

Na two term member of di Edo State House of Assembly and also di House of Representatives wia im rise to di position of di Minority Whip.

Im don dey involved for some ogbonge Legal practice across Nigeria and for di African continent.

Dr Osagie collect im first degree for Law from Obafemi Awolowo University, Ile- Ife, a qualifying Certificate for Law practice from di Nigerian Law School, a triple Master degrees in Law, Public Administration and International Relations. He also collect Doctorate Degree for Political Economy and Development Studies.

Im be Legal Adviser, Solicitor, and Consultant to many Corporate Organizations and development partners.

Edo State House of Assembly go need to confirm dis nominations bifor di appointments go dey official.

Oda tins Monday Okpebholo don do

Edo State Govnor Monday Okpebholo on Wedbesday disolve some political appointees and executives of board for Edo state, hours afta im appoint some key personnel for im cabinet.

Di newly sworn-in govnor sack all political appointees, executives of all board, agencies, parastatals and permanent secretaries wey dem appoint from outside di state public service.

“I hereby announce for di information of di general public say di govnor of Edo State, His Excellency, Senator Monday Okpebholo don approv di dissolution of executives of all Boards, agencies and parastatals in Edo State public service wit immediate effect," di statement tok.

“In addition, all Permanent Secretaries appoint from outside di State Public/Civil Service and all Political Appointees dey hereby relieve of dia appointments.

“Accordingly, all affected appointees go hand over all goment properties in dia possession to di most senior Public Officer for dia respective Ministries, Departments and Agencies.”

Okpebholo also order di immediate and indefinite suspension of di collection of all revenues in di state, especially in motor parks and odas until further notice.

E also order di state commissioner of police to arrest pipo wey go against di order, adding say e go di issues surrounding di collections soon and decide wetin to do.

“Di collection of revenues in di state don dey suspended indefinitely. dem go arrest anyone collecting revenues on behalf of di state goment," di statement tok.

Di govnor on Wednesday carry waka go inspect some failed portion of di Benin -Ekpoma -Auchi Federal government road.

E also order contractors wey bin leave dia work to return to site to begin repair internal roads inside Benin. di state capital.