Latest on Simon Ekpa as authorities for Finland take more steps against Ipob promoter

Wia dis foto come from, Simon Ekpa
Authorities for Finland don chook hand inside di matter of Simon Ekpa of di proscribed militant group Indegenous Pipo of Biafra (IPOB), wey land for prison ontop charges of alleged terrorist activities.
According to di new informate, di authority don take actions ontop assets of Simon Ekpa and odas afta dem gbab am for November 2024.
Report bin come for November say di District Court of Päijät-Häme send Ekpa, wey be Lahti-Nigerian municipal politician, go prison go chill on probable cause and on suspicion of publicly inciting pipo to commit crime wit terrorist intent.
Ekpa dey known for Finland as a local politician for di National Coalition Party.
In fact, tori find say im serve as a deputy councilor for di National Coalition Party and represent im party for di Lahti Regional Public Transport Board.
Simon Ekpa na from one small village Ohaukwu, for Ebonyi State, Southeast Nigeria.
Dem born am March 21, 1985, according to im profile for di website of World Athletics.
Im bin represent Nigeria for di 2003 Africa U20 Championships wia e compete for di 100m race, long jump and triple jump wia e win a silver medal.
Meanwhile, according to di Finland court for November, dem say Simon Ekpa dey allegedly spread separatist propaganda on social media and di charges against am na fro crime wey e commit from August 2021 for Lahti.
No be only Ekpa, four oda men on suspicion of terrorist offences also dey among dose wey di Finnish National Bureau of Investigation also demand dia arrest.
Dem keep Ekpa for Kylmäkoski prison for Finland.
Wetin be di latest on Simon Ekpa
Simon Ekpa still dey for di detention for Finland and dem don prolong im stay for di prison.
Local media, yle report say Ekpa still dey deny all di crime allegations wey dem sama am.
According to Ekpa lawyer, Ilkka Kopra, di police dey prolong di detention sake of say if dem release am, Ekpa fit hinder di investigation.
Di lawyer add say police tell am say if dem release Ekpa, e fit influence witnesses and kontinu im activities wey dem arrest am for.
Dis no be di first time wey Ekpa go dey di hand of Finland govment.
For February Finnish police gbab Ekpa but later release am afta one local journalist confam to di BBC say dem interrogated for some hours.
Na just bifor di 2023 general elections dat time, and di Nigerian goment bin ask Finland to check di activities of Ekpa, wey dey call for a boycott of National elections for Nigeria dat time.
Wetin go happun to Ekpa asset?
Although, Ekpa move to Finland for 2007 and e compete for di Finnish Indoor Championships in February 2009, and di Helsinki 4 Athletics GP in August of di same year, both as a Finnish citizen.
But e don become one popular pesin for kontri through help of social media.
Ekpa bin marry a Finnish woman and dem bin get one child who im bin dey show off for social media as im also sabi speak Finnish language.
According to di new informate, Ekpa dey among di pipo wey dem freeze dia assest sake of dia link to terrorism cases.
Dis go also affect all di companies and associations wey dey linked to Ekpa and di oda suspects wey dey face di charges.
Wetin Ekpa political party for Finland tok
Ekpa wey be member of di National Coalition Party (NCP) wey be di ruling political party for Finland get position as a representative for di public transport board for di Lahti region wia im dey live.
Meanwhile, local tori pipo tok say di party secretary, Timo Elo, no gree to tok about Ekpa membership of di coalition, but e agree say if a party member dey guilty of a terrorist crime, e fit lead to di expulsion of di member from di party.
About Ekpa position for di Public Transport Board, Elo tok say dat one go dey evaluated locally.
Anoda top member of di NCP, Pirjo Mäljä, say im no fit take any position on di matter for now until di police and judiciary don finish dia work.
E tok say Ekpa still be suspect and e never dey convicted, di investigation and legal process for di matter fit take years.
Di kwestion now na if Finland govment go extradite Ekpa come Nigeria.
Wetin be di process of extraditing EU citizens?
Normally, no sovereign nation dey under obligation to surrender a criminal to anoda nation, bicos evri sovereign nation get legal authority over pipo wey dey live within dia borders.
Dis na why bifor extradition go happun, di two nations involved suppose don get extradition agreement between dem.
Also, di nation wey dey request for di extradition must to get proof say di arrested suspect bin commit di crime for dia territory, or say di crime affect pipo wey dey live for dia territory.
Anoda factor wey fit affect di request for extradition na di human rights records of di requesting kontri. If di nation wey arrest di suspect no dey satisfied say di requesting nation go uphold di human rights of di suspect, dem fit no gree to hand am over, according to Vince Onyekwelu wey be former British Police officer and a security analyst.
Meanwhile, Uche Mefor, wey be di former second-in-command to Nnamdi Kanu for Ipob, bin chook mouth for di matter - e say to extradite Ekpa "go be a serious legal battle and Nigeria fit no succeed becos Simon na Finnish citizen".
Mefor believe say if di matter reach trial and jail, Ekpa go spend am for Finland not Nigeria.










