'I no regret di $17,000 bribe wey I reject'
- Author, Gift Andrew
- Role, Producer
- Reporting from, Lagos
Police officer Sentome Obi don become better example of wetin officers for Nigeria police suppose be.
Oga Obi enta limelight afta tori come out say e reject bribe worth $17000.
Tori be say na jaguda pipo bring di money to take induce di officer to release one of dia men from detention. Di suspect na alleged kidnapper.
Di suspect dey linked to di kidnap of Bayelsa State judge, Justice Ebiyerin Omukoro, on 21 June 2025 for Yenagoa, di Bayelsa state capital.
Dem hold di judge for 12 days before bifor a joint effort of security agencies for di state rescue am.
Di action of di officer draw di attention of police authorities and di goment of di state wey e dey serve, Bayelsa.
Police IG Kayode Egbetokun decorate officer Sentome Obi and shaparly promote am from Superintendent to Chief Superintendent of Police.
Im state Govnor Douye Diri of Bayelsa also dash am three bedroom flat, one car and recommend am to di police IGP for promotion.
Im and one oda officer ACP Aliyu Shaba, win best police officers of di year 2023 and 2024 and get accelerated promotion.

Na Mobolaji Olatunde shoot and edit am





