Baba Ijesha dey jailed for five years over 'sexual assault' charges - Court

Baba Ijesha case: Nollywood actor sentenced for 'sexual assault' - Lagos court convict am

Lagos court don judge say Nollywood actor Baba Ijesha dey guilty of attempted sexual assault of a minor.

Justice Oluwatoyin Taiwo of di Ikeja Sexual Offences Court pass di judgment on Thursday afternoon wen dem sentence Baba Ijesha to five years in prison.

Olarenwaju James [Baba Ijesha real name] dey guilty on four count of attempted sexual assault of underage pesin.

Prosecution fail to prove beyond reasonable doubt one count charge, di court tok.

But dem find di Nollywood actor guilty of four out of di six charges against am.

Baba Ijesha na popular Nigerian feem actor wey dey act Yoruba movies.

Lagos State goment lawyers alias prosecutors drag am to court on alleged sexual assault of a 15-year-old.

Tori be say di victim na adopted daughter of one Nigerian comedienne.

Baba Ijesha case verdict - How court judge di mata

Di presiding judge begin with summary of di arguments on Baba Ijesha case.

Defence lawyer, Dada Awosika [SAN] and Prosecutor counsel, Prince A Olabiran and dia team for lawyers bin don dey argue di mata for months.

Justice Oluwatoyin Taiwo say although di case don attract plenty media attention, di court must look for proves of di offence beyond reasonable doubt.

Baba Ijesha dey face six count of sexual assault of one 15-year-old girl.

Di charges include, indecent treatment of a child, sexual assault by penetration, attempted sexual.

According to di prosecutor, Baba Ijesha bin don assault di girl seven years ago.

Di goment lawyers argue say e happun wen she bin dey seven years old.

Dat time di actor putg im car key inside her virgina, di prosecution counsel tell di court.

Defence lawyer Prince Olabiran beg court to consider say di defendant Baba Ijesha na first offender.

E also ask di court to consider di fact say di defender na actor wey don impqct seriously for society sake of im career.

E add say di defendant get aged parents and im son wey still dey depend on am. E describe am a "very changed pesin".

Olabiran ask court to consider di least sentence.

Prosecutor counsel Martins want di court to decide how many years wey Baba Ijesha go get in total for all di four charges wey dem find am.

Case of molestation against Baba Ijesha

Ikeja Sexual Offences Court pass di judgment on di case of molestation wey happun seven years ago against Baba Ijesha.

Di court say e no fit conclude from di victime testimony say di offence happun without evidence.

Di minor also tell di court say anoda neighbour bin molest her before.

Justice Taiwo say, "di most important tin be say penetration happun...

"...but who or wen di penetration happun dey difficult to determine."

Baba Ijesha admit say im touch di body of di minor for 2021 and molest her.

But di actor deny say im no touch her at all seven years ago.

Baba Ijesha defence

Baba Ijesha, as part of in defence, say im bin go dey act script wit di minor.

Di Nollywood actor admit to di court say im bin no know say CCTV camera bin dey inside di house on dat day.

But di judge overrule, say di accused no dey act anything as no actor, no camera, no lighting or anything to show say dem dey act.

Di defence present four witnesses while di prosecutor present seven witnesses.

Charges against Baba Ijesha

Director of Public Prosecution for Lagos establish case against Baba Ijesha wit five court charges.

DPP recommend dem to charge am under five provisions of di 2015 Criminal Law of Lagos state.

  • Section 135, Indecent Treatment of a child -wey dey punishable by seven years imprisonment
  • Section 137, Defilement of a Child, wey dey punishable by life imprisonment.
  • Section 261, Sexual Assault by Penetration - e dey punishable by life imprisonment
  • Section 262, Attempted Sexual Assault by Penetration - wey dey punishable by 14 years imprisonment
  • Section 263, Sexual Assault - wey dey punishable by three years imprisonment

Baba Ijesha sentencing - How long di actor go stay prison?

Baba Ijesha case: Nollywood actor sentenced for 'sexual assault' - Lagos court convict am
Wetin we call dis foto, Di moment wen prison guards of Nigeria Correctional Centre dey escort Baba Ijesha enta dia motor afta Lagos court convict di Nollywood actor for 'sexual assault'.E dey sentenced to spend five years in prison.

Di Lagos court sentence Baba Ijesha to a total of 16 years but im go stay prison for five years.

Dis na sake of say all di jail time for each of di charges dey run at di same time alias concurrently.

A breakdown of di sentencing for each charge na:

Count 2 - Five years

Count 3 - Three years

Count 4 – Five years

Count 5 - Three years

Di judge clarify say di actor go serve all di jailterm at di same time.

So di Nollwood star go only stay prison for di highest number of years im gatz serve for a particular count charge.

In di instance na five years be di highest, so na dat long Baba Ijesha go dey jailed.

Court say di time go count from wen dem remand di man for prison.

Before Thursday 14 July, 2022 judgement, di actor don dey remanded in prison, pending di case outcome.

Nollywood actors Yomi Fabiyi, Princess react

Two Nollywood actors wey dey very familiar wit di mata don react to di judgement.

Actor, Yomi Fabiyi say wetin im dey tok right from time na say everybody under di law deserve right to fair hearing and fair trial.

Fabiyi wey also be human right activist add say di defendant get right to appeal if e think say im wan fight for im innocence.

Wetin im stand for na say make nobody suffer unjustly until proven guilty.

Nigerian comedian Princess take to her verified Instagram page moment news break say Lagos court find Baba Ijesha guilty of ‘sexual assault charges’.

"God no be ma", di Nigerian comedienne write on her timeline. Learn more about di judgement: