Nigeria Police promise beta security for across kontri afta US embassy for Abuja mention risk of terror attacks

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Inspector General of Police Usman Alkali Baba don announce di immediate operation of “Darkin Gaggawa”, wey be Counter Terrorism Incident Simulation Exercise in response to security intelligence reports for Abuja, di Nigerian capital.
On Sunday, America release security advisory wey warn of high risk of terror attacks specifically for Abuja.
Di Nigeria Police Force for inside statement tok say e go review di US advisory and no go take any threats intelligence, weda actionable or not for granted.
Di statement add say di IGP also don order di Commissioner of Police for di FCT plus oda state commands ogas to re-strategize security management for dia domot.
Di US Embassy for inside Sunday statement bin say “Elevated risk of terror attacks for Nigeria, specifically for Abuja. Targets fit include, but no dey limited to, goment buildings, places of worship, schools, markets, shopping malls, hotels, bars, restaurants, athletic gatherings, transport terminals, law enforcement facilities, and international organizations."
Dem come say dem go reduce as dem dey work until further notice.
Di Nigeria Department of State Services (DSS) before now bin ask say make pipo chill say dem dey work wit oda security agencies to maintain peace and order for Abuja and outside di capital.
Di Service bin advise say make pipo take di necessary precautions and remain alert.
Dem follow add say citizens fit assist security agencies with useful information on top threats and suspicious criminal acts around dem.
DSS say dem don receive several enquiries relating to di security advisory wey US Embassy drop on Sunday 23 October, 2022 as dem say no be new tin as di service also don issue similar warnings for di past.
Oda tins for di US Embassy advisory be tins wey pipo fit take to reduce risk wey include to avoid all non-essential travel or movement and for pipo to review dia personal security plans.
No be di first time wey US embassy go release security advisory be dis.
For April, 2021, US embassy for Lagos release security alert for pipo wey dey stay for di Nigeria commercial capital.








