Wetin you suppose know about di nutritional values of Pawpaw

Wia dis foto come from, Getty Images
Di leaves, di fruits wey contain small black seeds wit a pepper flavor, di stem, everitin about dis tree dey useful. Di pawpaw tree na evergreen fruit-tree for di humid and sub-humid tropical regions wey dem dey grow sake of di pawpaw fruit.
Na exotic fruit wey belong to di Caricaceae family, di pawpaw dey connected to di tropical America. E get orange-green skin wit orange flesh wey contain di black seeds wey dey inside am. Na settlers bin bring dis fruit back to Africa and India.
According to specialists, pawpaw trees get male feet, female feet and bisexual feet. Only females and bisexuals dey produce dis pleasant pawpaw fruit wey get pleasure to eat.
For im fifties, Uncle Charles (as e dey call himself), a Togolese entrepreneur wey don go live for Dakar for more dan a decade, never fail to get pawpaw fruit for im basket. Na almost a "grandmother secret", wey be tori between im and dis fruit since im don know di many benefits wey e get and di role for intestinal well-being.
"I know fit remember wen I take drug to treat any constipation or di inability to get easy bowel movement. Ripe pawpaw na di solution to di problem wey dey make many pipo run to di pharmacy," im tok.
"Nature don give us evritin for Africa," im like to dey tok dat one to anyone wey wan listen. Charles get two pawpaw trees for house and im dey "use di little black seeds of di pawpaw and di leaves to treat wounds."
Nutritional values of pawpaw

Wia dis foto come from, Getty Images
Pawpaw dey usually covered wit green skin wey dey turn yellow wen e ripe. At dis stage, you gatz eat di pawpaw to benefit from all di taste and quality. E get delicious fragrant taste.
Pawpaw na fruit wey rich for fiber and high in vitamins. According to nutritionists, e contain antioxidant substances wey di body need for proper functioning.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to Alfred Kanssou, dietician-nutritionist for Cotonou, 100g of papaya contain 42.2g of calories, 0.75g of protein, 8.53g of carbohydrates, 0.2g of fat, 1.8g of dietary fibre. E also contain glycemic loads and antioxidants.
"I no need to dey buy vitamin C for pharmacy anymore. Pawpaw contain so much wey be say to dey consume am always fit satisfy all di nutrient wey di bodi need. Na fruit wey I don always recommend to doz wey dey find vitamin C for food," Uncle Charles tok.
Nutritionists claim say you fit get di daily intake of vitamin C if to say you dey chop pawpaw well well .
Na fruit wey contain vitamin A, especially for women. Pawpaw na also a source of vitamin E, B5, B9 and potassium.
Di benefits of pawpaw

Wia dis foto come from, Getty Images
Nutritionists don always dey tok about di health benefits of antioxidants for fruit. And of course, pawpaw bin also contain elements wey be protective agents of di body against cancer cells.
According to Dr. Kanssou, e dey best to consume pawpaw wen e dey fully ripe to benefit from di antioxidant effect, especially di vitamin E wey e contain.
"Eating ripe pawpaw dey help pesin wey get stomache pain to dey comfortable. And since I bin learn from my nutritionist say e fit be effective protector against cancer, I no dey miss di opportunity to consume am. Na why I dey always get dis tree for my house," Charles tok.
However, specialists point out say di regular consumption of pawpaw by women and to combine am wit oda fruits such as melon, fit reduce di risk of breast or cervical cancer.
Di orange coloration of pawpaw come from di beta-carotene wey e contain. Dis element wey be antioxidant fit promote di production of vitamin A sake of di carotenoid (cryptoxanthin in particular) wey dey responsible for anti-carcinogenic activities, according to nutritionists.
"Pawpaw contain a type of carotenoid, cryptoxanthin, wey fit reduce di risk of atherosclerosis for humans," Dr. Alfred Kanssou tok. Im also add say dis fruit contain lycopene, especially wen e dey fully ripe.
Dr Alfred say consumption of foods and fruits wey contain lycopene fit reduce di risk of prostate cancer. Pawpaw na also source of dietary fiber, wey dey recommended for both humans and animals.
"E get liquid wey dem dey call latex wey dey between di flesh and di skin of di pawpaw. Na wen di fruit neva ripe e dey show. Enzyme dey insde latex wey dem dey call papain. Na di enzyme through di keratolytic effect dey eliminate dead cells for di surface of di epidermis witout disturbing di healthy cells," Dr. Alfred tok.
Di ogbonge doctor add say pawpaw bin also get cosmetic properties.
According to am, di beta-carotenes for pawpaw also dey good for di hair. Dey help dem grow back and make dem flexible and strong. Doz wey dey get hair loss fit use am.
"My hairdresser bin recommend pawpaw to treat my baldness, but I no find di need to do am. I recognize say dem dey tok a lot about pawpaw to heal di hair. I dey use di whole plant and fruit for my care," Charles admit.
Good for diabetics
Pawpaw also get anti-diabetic effects, according to some specialists wey sabi dis fruit. Dem dey use am as stimulant for di treatment of type 2 diabetes. Di carotenoids wey be polyphenols inside pawpaw dey give am antioxidant properties wey dey fight diabetes.
Pawpaw seeds na real remedy against worms

Wia dis foto come from, Getty Images
Many pipo dey use di black seeds inside pawpaw to cure certain health-related problems. Di most well-known na di solution to worm problem. "Pawpaw seeds dey veri effective to treat worms," Uncle Charles tok.
Dem dey effective against fungi, worms, including roundworms, pinworms, and bacteria.
In addition to dia use as dewormer, pawpaw seeds fit also aid digestion.
"You fit take 3 to 4 seeds, chew dem well and swallow dem. But I get di habit of drying dem, den crushing dem to get powder wey I dey put for porridge or inside glass of water to drink. Dis help to balance di intestinal flora and fight against certain digestive parasites," di nutritionist confam.
Di essential fatty acids dey inside di seeds wey go help calm inflammation. Dem dey also relieve joint pain, osteoarthritis, etc.
And make we no forget di pawpaw leaves

Wia dis foto come from, Getty Images
Di pawpaw tree as a plant get medicinal properties.
Dem dey play protective role against stress sake of di richness in antioxidants. Dem also get virtues against premature cellular aging.
You fit put few grams of pawpaw leaves inside hot water. Na herbal tea wey pesin fit drink like three times a day, afta passing di extraction under a filter.
Di pawpaw tree as plant get medicinal properties. E dey allow wound healing, treat acne, insect bites, oedema, irritation. E dey act as anti-inflammatory, analgesic, etc.
To get di tree for home na treasure. From di leaves to di roots, including di stem and di delicious fragrant fruits, di pawpaw get many recognized virtues.














