Meet ogbonge Nigerian baker wey her large art cakes dey burst pipo brain
Meet ogbonge Nigerian baker wey her large art cakes dey burst pipo brain
Ogbonge Nigerian baker Ezinne Okonkwo dey burst brain wit her large cakes wey she dey create.
Di baker tell BBC News Pidgin say she dey like create design wey no dey common and she like to dey take risk.
Ezinne also tok say plenti of her projects don challenge but e get three major ones wey bin shake amd make her BP rise.
She say one of di projects wey challenge am na yacht cake wey she create.
"Dat cake e take me two weeks take do am. E get di time wey afta one week, evri tin wey we don do just fall yakata for ground," she tok.
Video: Monday Idara





