States wey don impose curfew for di middle of protests in Nigeria and why

Wia dis foto come from, Prof Zulum Babagana/Facebook, Abba Yusuf/Facebook, Mai Mala Buni/Facebook, Dikko Radda/Facebook
Some states across Nigeria don impose curfew afta suspected thugs hijack di nationwide protest against di cost of living wey start on 1 August.
Demonstrators for all major cities enta streets, begin chant slogans like: “We dey hungry, end bad governance", among odas.
Di protest wey bin start peacefully bin turn violent for some northern states as suspected hoodlums hijack am and use di opportunity for widespread looting and destruction of property.
States like Kano, Yobe, Nasarawa, Katsina and Borno compulsory curfew for some of di volatile local goment areas for di states.
While some of di curfew na 24 hours, odas na 12 hours.
Di curfew don effectively bar protests from continuing for dis states and all residents dey expected to stay for house.
States wey don impose curfew

Kano State
Kano, Nigeria second biggest state witness one of di largest turnout of crowd on di first day of nationwide protest wey force many businesses to close.
Police bin fire live bullets and tear gas – dem also spray hot water - to pursue thousands of demonstrators for Kano city.
One hospital official for Kano confirm to BBC say three pipo don die and many odas don injure.
Di hospital official allege say na security agents shoot di deceased.
Protesters bin earlier burn tyres to make bonfire in front of di house of state di govnor, Abba Kabir Yusuf.
Looters also burst into warehouse near im house and fotos show as pipo carry 25-litre cartons of vegetable cooking oil and mattresses for dia head wey dem tiff from di warehouse.
Sake of di violence for di state, Govnor Yusuf declare 24 hours curfew for di state.
Di govnor declare di curfew on Thursday, di same day di protest start.
One tok-tok pesin of di govnor, Sanusi Bature tok say di protests bin dey peaceful for Kano, but di govnor dey forced to declare a curfew to "restore order and ensure di safety of our communities" becos of "rampant looting, destruction of property and violence" unleashed by "thugs".

Borno State
Di govnor of Borno State Babagana Zulum don declare 24 hours curfew for di north-eastern state.
Dis dey come afta one bomb blast kill at least 16 pipo on Wednesday night, according to di state police.
One Improvised Explosive Device bin explode for one tea shop wey many pipo for Kawori, one rural community for di state dey go relax.
Police officials tok say di explosion occur around 20:00 for di Konduga area, approximately 50 km (32 mi) from Maiduguri.
Police add say 20 odas dey ‘critically’ injured.
Details of di blast, including casualties still dey sketchy but residents dey suspect say na members of Boko Haram wey don dey active for di northeast since 2009 plant di explosive device for di place.
Di restriction of movement dey come for di middle of di nationwide protest wey start on Thursday.
Young pipo for Maiduguri bin enta streets afta di attacks, to join for di protest against bad governance for di kontri.

Katsina State
Katsina state goment don declare twenty four hours (24hrs) curfew for Dutsin-Ma local goment area of di State.
Di acting govnor Faruk Lawal also ban “unusual gathering and all types of protest throughout di state.”
For one statement on Oga Lawal Facebook page, e say di state executive council on Thursday, 1 August approve di 24 hours curfew for Dutsin-Ma local goment area and 7:00am to 7:00pm curfew for di remaining 33 local goment areas of di state.
Di govnor say dis action don become compulsory to protect di lives and property of pipo sake of di report of breakdown of law and order for some parts of di state, wey happun as a result of di nationwide protest.
“Di state goment don receive reports say some jaguda pipo don hijack di protest, and don begin break shops, loot and vandalize public and private properties.”
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post

Yobe State
Yobe state goment don impose 24-hour curfew for Potiskum, Gashua, and Nguru towns wia some hoodlums take advantage of di protest to vandalise and loot goment and private properties.
Dem burn seven mass transit for Potiskum, di headquarter of Potiskum local goment area of di state on Thursday during di #EndBadGovernance nationwide protests.
Tok-tok pesin of di Yobe state police command, Dungus Abdulkarim confam dis incident to Channels Television.
Dairy Abdulsalam, Special Adviser to Governor Mai Mala Buni on Security Matters, say make residents sit down for house and obey di curfew order for peace to reign for di affect areas and di state at large.
E say dem don station security pipo and direct dem to ensure say pipo comply wit di curfew order.

Nasarawa
Na 6pm to 6am curfew goment impose for Karu local goment area of Nasarawa state.
Di curfew na till further notice.
Di chairman of Karu local goment, James Thomas wey compulsory di curfew afta di nationwide protest turn violent for di area say na to restore calm and order.
Hoodlums allegedly hijack di protest and e result into destruction, looting, stealing, highway blockade, and vandalism for Mararraba area, di border between di state and di kontri capital, Abuja.
States wey don relax curfew and for how long
Kano state goment don announce di partial relaxation of curfew for di state.
Now, residents of Kano dey free to go about dia business from 12pm to 5pm from Friday.
Dis announcement dey timely becos e go now allow Muslims for di state to go observe dia Friday Jum'at prayer.
Also Borno State goment relax curfew for di state. Di curfew go be from 12pm to 3pm on Friday.
From 6am on Saturday, members of di public fit go about dia lawful businesses and shun violence, according to di state police command.
Dis dey come less dan 24 hour hours wey di state goment impose curfew on di state afta di EndBadGovernanceinNigeria protest turn violent for dia.

Wia dis foto come from, Borno Police Command/X










