Junior Pope: Water wash deadi body of crew members come near river - Police confam

Wia dis foto come from, Instagram/jnrpope
Di marine police for Anambra state don recover three more deadi body comot for di unfortunate water accident wey kill popular ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope.
Dis na two days afta Junior pope and some oda crew bin involve for accident wey claim dia life for 10 April 2024.
Three crew members wey dey involved for di boat accident wey take di life of di Nollywood actor dat day, bin dey miss bifor as dem no quickly fnd dia body.
According to di police tok tok pesin for Anambra state SP Tochukwu Ikenga, dem recover two bodies for Thursday 11 April 2024 and water carry di last one come for Friday morning.
“We don deposit all di deadi bodies for hospital mortuary. Na water carry di last deadi bodi come dis morning,” di police tok.
Police say dem don inform di presideo of di actors guild say dem don find di oda bodiesand dem go begin investigation into di sad accident wey kill five actors.
“D oga of police, CP Aderemi Adeoye dey beg water trasnporters make dem dey safety conscious and avoid behaviour wey fit put di life odas into wahala wen dem dey go ontop water,” police tok tok pesin add.
Actors chop warning, Adanma Luke suspended – AGN take action afta Jnr Pope death
Di sudden death ogbonge Nollywood actor Junior Pope bin make di Actors Guild of Nigeria (AGN) announce serious actions for di industry.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem don identify one Mr Friday wey also die for di incident and three deadi bodies still dey miss.
As di matter happun, di president of di actors guild Emeka Rollas no gree as im announce serious actions for di industry sake of di recent sad incident
Di news of di death of Junior Pope first hit di social media for Wednesday night, later tori come say im dey alive. E no too long na im Oga Rollas confam dis for post e do on im Facebook account on Wednesday, 11 April say Junior Pope no make am alive.
'Make no actor do movie wit producer Adanma Luke'
Actors guild shapaly suspend all di movies wey be say e involve water areas or any movie wey be say boat riding go dey involve till further notice.
Dis na sake of di water accident wey claim di life of dia colleague make di president announce dis new suspension.
“All films wey involve riverine areas and boat riding dey suspended indefinitely,” di Oga Rollas tok.
Di president also tok say make no actor shoot any movie for any locations nationwide on Thursday 11 April 2024.
As part of actions against di producer of di movie wey Junior pope and odas bin dey go shoot, di actors guild say make no actor do any feem wit di producer Adanma Luke.
“Di feem titled ‘another side of life’ dey suspended indefinitely. No actor dey allowed to work wit Adamma Luke as producer till further notice.”
Adanma Luke na movie producer for di nollywood industry and she dey known for different movies wey she don make online.
According to Oga Rollas, dem still dey find di remaining bodies of oda pipo wey fall inside water.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Moments bifor Junior Pope bin die for water
According to one eyewitness, im say dia boat collide wit anoda one sake of say di boat rider no quickly see di oda boat wey dey come. As di boat collide wit each oda, dione wey carry dem Junior pope bin fall inside di water.
On di day wey di boat accident bin happun, Junior Pope bin make a post for im Instagram account wia im tok about how actors risk dia lives to entertain dia fans.
Junior say im bin dey cross River Niger on Tuesday 9 April wit no life jacket and add say im get three pikin dem and na im go raise dem.
"Na only dem born oh, na only me dem born, I get three children na me go raise dem, I get three children na me go raise dem oh, bros abeg, oh Jesus wetin be dis, bros abeg na abeg...
"Abeg take am small small... See di risk we take, pipo, to entertain you, live and direct on River Niger," Junior Pope tok.
Unfortunately, im no make am alive as dia boat capsize inside di water.
Pipo mourn Junior Pope
Former senate president of Nigeria Dr Abubakar Bukola Saraki say di nollywood don suffer a huge loss.
“Dis sudden loss repreent a tragedy for di entertainment industry, may di family fin strength for dis difficult time,” Saraki post for im X page.
Di presidential candidate of di Labour Party Peter Obi also send condolence to di family of Junior Pope describing his death as a shocking one.
Obi write for im X page say di death of Junior pope na very painful experience and more devastating becos im young and get promising future.
“I dey shocked by di reports of di death of anoda vibrant Nollywood actor, Pope Obumneme Odonwodo, popularly known as Junior Pope. Our entertainment industry and our dear nation dey mourn di death of dis young talented actor.”
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post













