Former presidential aide Doyin Okupe don die

Foto of Doyin Okupe

Wia dis foto come from, Doyin Okupe/Facebook

Read am in 4 mins

Nigerian politician, Doyin Okupe, don die at di age of 72.

Reports tok say e bin dey battle serious sickness wey dem suspect to be cancer.

Okupe, na medical doctor wey turn politician for Nigeria.

E work as tok-tok pesin for both former presidents Olusegun Obasanjo and Goodluck Jonathan.

For 2022, im lead di Obi presidential campaign under Labour Party.

Reactions don already dey come in as tori of e death spread.

Labour party presidential candidate for di 2023 election, Peter Obi don mourn di passing of Doyin Okupe for im X page on Friday.

Obi tok say Okupe na active figure for di national political space wey desire beta Nigeria.

"Wit great sadness dis morning, I receive di shocking news of di death of my dear elder broda, Dr. Doyin Okupe. On behalf of di family and di Obidient family, I sincerely mourn im passing," e tok.

"Dr. Okupe na active figure in di nation political space and man wey desire betta Nigeria.

I go therefore like to urge members of di Obidient Movement and oda group make dem pray for di eternal rest of Dr Okupe soul and to remember im family during dis trying times."

Meanwhile, Ogun state Govnor, Dapo Abiodun don tok say di passing of Doyin Okupe, leave am wit "profound sense of personal loss."

Lekan Adeniran, tok-tok pesin to di govnor say Okupe service to Nigeria remain patriotic.

Di govnor tok say Okupe ensure and resist di military rule to stand firm for im democratic conviction.

E tok say Okupe service reflect im deep love for Nigeria and di pipo.

Oga Abiodun send im prayers to Okupe family.

"My sincere prayer to Almighty God make im grant di family di strength to bear dis irreparable loss. Adieu, dear broda. May your soul rest for eternal peace.

Receiving di news of di passing of my elder broda, Dr. Doyin Okupe just leave me wit profound sense of personal loss, especially afta di transition of di Alaperu of Iperu Remo, Oba Adeleke Idowu-Basibo without doubt, Dr. Okupe leave empty space wey nobody fit fill," e tok.

Even afta di 2023 general election, im openly admire President Bola Ahmed Tinubu progressive vision."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Tok-tok pesin to former President Muhammadu Buhari on new media, Buhari Tolu Ogunlesi, on im X account tok say make im soul rest in peace.

"Dis October 1985 @nytimes piece profile 33-year-old Dr. Doyin Okupe and im Royal Cross Hospital for Obalende, Lagos, wey im co-founded wit Dr. Seyi Roberts and Dr. Ladi Okuboyejo. Make Okupe soul rest in peace. Amen," e tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Who be Dr Doyin Okupe

Dem born Adedoyin Ajibike Okupe, wey pipo sabi as Doyin Okupe, on March 22, 1952, for Iperu-Remo, Ogun State, Nigeria.

Okupe do im primary school education for St. Jude School in Lagos and secondary school education for Igbobi College bifor im attend College of Medicine, University of Ibadan, wia im earn im first degree as medical doctor.

Di medical practitioner co-found Royal Cross Medical Centre for 1983 for Lagos, im also work as advocate for public health.

Okupe launch for politics under di National Republican Convention (NRC) as di national publicity secretary in 1999. E serve as tok-tok pesin for both former presidents under di People Democratic Party (PDP) Olusegun Obasanjo and Goodluck Jonathan.

For 2012, former President Goodluck appoint am as a Senior Special Assistant on Public Affairs.

E work as Director-General of di Labour Party (LP) presidential campaign for di 2023 election.

E later dump di party sake of wetin e describe as 'ideological differences.'

For December 2022, court find Okupe guilty of breaking money laundering laws afta im collect ova 200 million naira in cash from former National Security Adviser, Sambo Dasuki.

Di court sentence am to two years in prison wit di option to pay N500,000 fine for 26 counts (13 million naira), wey im later pay.