Ghana floods: 'Water carry all our belongings go'

Ghana floods: 'Water carry all our belongings go'

Health officials for over 100 communities wey flood don submerge for volta and eastern regions for Ghana dey blow alarm say water-borne disease outbreak fit happun.

Di volta river authority (VRA) don spill excess water for Akosombo and Kpong hydroelectric dams wia submerge di communities for over nine districts. Di flood affect schools, hospitals, churches, businesses and houses as many residents for north tongu, central tongu, south tongu, ada, azizanya all lose dia belongings.

Victims say dem lose everything. So far di flood displace over 26,000 pipo as di navy, national disaster management organization (NADMO) dey still rescue pesin wey trap for dia flooded homes. President Akufo-Addo don visit some of di victims wey im promise say goment go support dem.

Di displaced pipo dey seek shelter for schools and churches, na der NADMO dey distribute food and water give dem.

As di volta river authority (VRA) continue dey spill di water from di dams, di devastation go be worse.

VRA say di spilling of di water be necessary to ensure “di integrity of di two dams,” na so pipo wey dey along di lower volta basin for relocate before di water go reach dem.

Plenty groups don dey call on di goment to declare state of emergency for dis areas.

Video by Komla Adom and Olawale Adekola