I go comot office on 2 April no mata di election result - President Macky Sall
I go comot office on 2 April no mata di election result - President Macky Sall
Macky Sall, Senegal president, don refuse to apologise to di pipo of im kontri for di deaths and di political katakata wey follow im decision to postpone elections last month.
Inside interview with BBC, di outgoing president confam say e go leave di presidential office on 2 April regardless of di election result.
Senegalese voters dey go to di polls on Sunday to elect a new head of state.





