Nigeria serve Sao Tome & Principe wotowoto promax wit 10 goals to nil

Super Eagles striker Victor Osimhen

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Super Eagles striker Victor Osimhen

Nigeria Super Eagles beat Sao Tome & Principe 10 to nil today for di Group A of di Africa Cup of Nations qualifiers at di Adrar Stadium for Agadir, Morocco.

Victor Osimhen wey be di star of di match score four goals for Nigeria during di match.

Super Eagles winning dey come afta dem beat Sierra Leone 2:1 for di Moshood Abiola Stadium in Abuja on Thursday 9 June.

Na three goals Nigeria score for first half and na Osimhen score di first goal while Simon Moses score di second goal. Terem Moffi score di third goal.

Oda players wey score for di match na Etebo, Lookman and Dennis Emmanuel wey score wit penalty.

Na di second time Jose Peserio go win match for Nigeria since im take over from Augustine Eguavoen.

Na only two of di four teams wey dey for Group A go qualify for Afcon 2023 wey go shele for Ivory Coast.

First half update

45 mins: Sao Tome & Principe 0 - 3 Nigeria

Di ball possession for Nigeria na 71% while Sao Tome & Principe get 29%.

Nigeria hold di ball till referee blow whistle for end of second half.

Referee Koto O don add two minutes.

44 mins: Di Super Eagles still dey lead and dem apply pressure to score di fourth goal as dia opponents no gree dem.

43 mins: Terem Moffi score third goals for Nigeria.

41: Di Falcons dey find dia first goal as dem hold di ball but Super Eagles collect am back.

39 mins: Free kick for di Falcons.

Moffi shot enta di Falcons keeper hand.

34 mins: Di Super Eagles dey control di match and dia opponents neva proof too difficult for dem.

33: Osimhen enter offside as e want score di third goal.

31 mins: Free kick for Sao Tome & Principe.

28 mins: Moses Simon score di second goal for Nigeria afta assist by Osimhen.

Nigeria dey press for di second goal.

First corner kick for di Super Eagles.

Victor Osimhen score second goal for Nigeria but na offside.

9 mins: Victor Osimhen score first goal for Nigeria.

Second half update

Super Eagles

Wia dis foto come from, Getty Images

Referee blow di final whistle

Nigeria ball possession na 66% while Sao Tome & Principe get 34%.

90+2 mins: Emmanuel Dennis score tenth goal for Super Eagles wit penalty.

Referee blow penalty whistle for Nigeria afta dem fall Emmanuel Dennis.

Referee add two minutes more for di game.

89 mins: Sao Tome & Principe attempt for dia first goal but e no enta.

84: Victor Osimhen score di ninth goal for Super Eagles. Na im fourth goal for di game be dat.

81 mins: Umar shoot but di goalkeeper catch am.

Dem deny Nigeria anoda goal for offside.

74 mins: Cooling break.

Leon Balogun enta for Calvin Bassey, Emmanuel Dennis enta for Ademola Lookman, Sadiq Umar enta Terem Moffi.

Some substitutions for di Super Eagles.

Sao Tome & Principe dey find penalty as dia player fall for 18-yeard box but referee say no.

66 mins: Sao Tome & Principe still dey find dia first goal but Nigeria no allow dem hold ball for long.

65 mins: Victor Osimhen score hattrick as e score Nigeria 8th goal.

64 mins: Lookman score di seventh goal for Super Eagles.

60 mins: Terem Moffi score di sixth goal for Super Eagles.

58 mins: Ahmed Musa substitute for Moses Simon.

58: Nigerian defender Aina chop yellow card.

56 mins: Osimhen score wetin suppose be hattrick but offside.

55 mins: Etebo use free kick score Nigeria fifth goal.

52: Across from Di Falcons as dem still dey find dia first goal.

51 mins: Nigeria still dey in charge of di ball possession as dem dey press dia opponent.

48 mins: Victor Osimhen score fourth goals for Nigeria.

Sao Tome & Principe vs Nigeria head to head

Sao Tome & Principe and Nigeria battle each oda today in di Group A of di Africa Cup of Nations qualifiers at di Adrar Stadium for Agadir, Morocco.

Dis dey come afta di Super Eagles sama Sierra Leone 2:1 for di Moshood Abiola Stadium in Abuja on Thursday 9 June.

Na di same day wey Super Eagles defeat Sierra Leone Sao Tome & Principe chop 5:1 from Guinea-Bissau.

Afcon 2023 qualifiers preview: Sao Tome & Principe vs. Nigeria

Wia dis foto come from, @NGSuperEagles/Twitter

Wetin we call dis foto, Super Eagles of Nigeria

But defeat of Guinea-Bissau na Nigeria first win in five matches since dia embarrassing loss for Afcon 2021 for Cameroon and dia failure to beat Ghana to qualify for di Qatar 2021

Di Falcons wey never meet wit di Super Eagles before dey face di three-time African champions for di first time.

Tori be say Sao Tome & Principe neva qualify for di Africa Cup of Nations before and Nigeria don collect am three times.

Di match dey shele today at 14:00 (2pm Nigerian time).

Di 2023 Africa Cup of Nations go shele for Ivory Coast.

Nigeria team line-up

Uzoho (GK), Aina, Zaidu, Ajayi, Bassey, Etebo, Simon (C), Iwobi, Moffi, Lookman, Osimhen.

Nigeria team substitutes

Adewale, Onyeka, Balogun, Musa, Aribo, Cukwueze, Shehu, Adeyinka, Dennis, Umar, Dessers, Omeruo.