Angola former President Dos Santos don die

Dos Santos don die

Wia dis foto come from, Reuters

José Eduardo dos Santos, Angola second president wey rule di oil and diamond-rich state for almost four decades don die.

Oga Eduardo die at di age of 79, na so goment announce.

Im die for one clinic for Barcelona on Friday afta one prolonged illness.

Dem go remember Dos Santos as pesin wey end one long-running civil war for di early 2000s - di achievement wey don earn am di title of "architect of peace"

But accuse of corruption and human rights violation under im regime don stain im legacy.

Di Executive of di Republic of Angola for inside statement say "we bow, wit di greatest respect plus consideration, to di ogbonge Statesman of great historical dimension."

According to dem Oga Eduardo rule Angola for many years wit clarity and humanism.

Timeline of Eduardo Dos Santos rule for Angola

Eduardo Dos Santos profile

More tins to sabi about di Angola former leader

José Eduardo dos Santos

Wia dis foto come from, Getty Images

Oga Eduardo graduate for petroleum engineering for di Soviet Union for 1969.

Dos Santos na only 37-years-old wen im become Angola president ten years afta di death of di first president, António Agostinho Neto.

At dat time, just four years afta di kontri gain independence for 1975, di kontri enta civil war.

Di war na between di two groups wey fight against Portuguese colonisation - Dos Santos' MPLA and Unita.

Di war last for 27 years and ravage di kontri. 

Na about 500,000 pipo dem believe say e die for di conflict. 

E also draw in foreign powers, wit South Africa - then under white-minority rule – as dem send troops to support Unita, while Cuban forces intervene on di goment side.

Dos Santos rule over one Marxist-oriented one-party state until di Soviet Union collapse and di end of di Cold War lead to di MPLA and Unita to sign one peace accord.

Dos Santos and Unita Jonas Savimbi face off against each other for di first multi-party elections wey happun for Angola since independence.

Dos Santos defeat Savimbi wit a narrow margin, wey make dem call off di second round, but Savimbi boycot am, as e choose to take up arms again.

Just over one decade later, for February 2002, Dos Santos's troops kill Savimbi and dem sign peace deal wit di new Unita leadership.

"Not one more shot, we need to preserve di people alive and negotiate peace," Dos Santos tok am dat time, wen im wan formally declare di end of di war.

Reconstruction and reconciliation na Dos Santos main goals.

At dat time, im enjoy popularity, as we see am during di victory of di MPLA for di 2008 elections wen e gbab 82% of di vote.

Di rise of Dos Santos family

For subsequent years, dem sama plenty accuse of high-level corruption, especially for di oil sector, mismanagement of di economy and crackdown on political dissent ontop Dos Santos administration.

Dos Santos, wey gain di reputation say e be cold and distant president,no tok anything on dis accuse publicly, as pipo no dey content wit im regime, dis one lead to increase in im personal and family security.

For one rare sit-down television interviews, wey im do for 2013, Dos Santos tell Portuguese channel SIC say Angola deycompletely stable, and e say di group wey no like im regime dey small and im sab idem well-well.

By dis time, nepotism don already dey common.

Im appoint e close family members and friends to ogbonge positions for government, including im son José Filomeno dos Santos, wey dem sabi as Zenu, e appoint am as head of Angola Sovereign Wealth Fund, and later, e appoint im daughter Isabel dos Santos as head of di state oil company Sonangol.

Isabel later become Africa richest woman.

As time dey go, e come be like say Angola dey turn into one dictatorship, as dem presecute and even kill opposition politicians, civil rights activists and plus journalists.

One of di cases wey become popular around di world, and certainly affect Dos Santos legacy, na di arrest of 17 activists wey dem accuse of accused of "crimes of rebellion" and say dem dey plot coup.

Wetin be dia crime? For 2015, dem see dem dey read di book , From Dictatorship to Democracy: A Conceptual Framework for Liberation, wey American writer Gene Sharp write.

For 2017, 38 years afta im first take di oath of office, Dos Santos surprise many Angolans as im step down.

E choose im former Defence Minister, João Lourenço, as im sucessor.

One year later, Dos Santos also resign as leader of di MPLA. For im last speech to di party, im admit say im make mistakes during im long time in power.

"Mistakes na ogbonge part of di improvement process, so we dey learn form our mistakes," im tok am Infront of one crowd.

Dos Santos also tok say im comot office wit im heads – as im party give am di title of "emeritus president".

But im position bin dey fragile.