Iran pro-goment protesters dey call for execution of hijab rioters

pro-goment Iran protesters

Wia dis foto come from, Getty Images

Iran goment-support protesters don call for di execution or killing of rioters.

Di pro-goment protests dey happen to counter anti-goment protest wey dey happun for 80 cities and towns all over di kontri sake of one girl wey die for police custody.

Mahsa Amini bin allegedly die afta morality police bin arrest and beat her say she do “improper hijab.”

Di protests dey follow strong warning from authorities, wen Iran army tell di kontri pipo say dem go confront "di enemies" wey dey behind di i-no-go-gree waka. - tok wey fit be signal of di kain crackdown wey bin crush protests before.

Di goment supporters dey also shout “Death to America” and “Death to Israel.” Dis kain tok na im di kontri religious leaders dey use to attempt to fire up help for authorities.

More tori of wetin dey shele for Iran

Iran army go confront "enemies"

Iran army on Friday say e go "confront di enemies" to make sure say dem maintain security.

Dis na di toughest warning yet to protesters wey dey do i-no-go-gree all over di kontri sake of di death of one woman wey die for di hand of morality police.

Iran pipo don dey do nationwide prtest sake of di case of Mahsa Amini, 22, wey die d last week afta morality police arrest her for wearing "attire wey no proper".

Di army say "dis desperate actions na part of di evil strategy of di enemy to weaken di Islamic regime".

E go "confront di enemies' different plans in order to make sure say security and peace go dey for di pipo wey dem unjustly assaulted," e tok.

Di kontri pipo dey plan to do more i-no-go-gree plus goment-support protest on Friday, Iran media tok.

protesters across Iran dey vex say morality police arrest and beat Mahsa Amini

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Protesters across Iran dey vex say morality police arrest and beat Mahsa Amini

Iran media describe di goment-support protest wey go happun afta Friday prayer as "roar of pipo zeal against rioters".

Iran religious rulers dey fear revival of di 2019 protests wey bin happun sake of gasoline price increase, di bloodiest protest for di Islamic Republic history. Tori pipo Reuters bin report say 1,500 pipo die for di protest.

For di latest protest, protesters for Tehran and oda cities don burn police stations and vehicles as dem dey para over Amini death no show any sign of ending wit report say security agents dey under attack.

Iran media don report di arrest of 280 rioters on Thursday.

Amini death provoke pipo anger again over issues including restrictions on personal freedoms for Iran - including strict dress codes for women - and economy wey turn upside-down sake of sanctions.

Mahsa Amini protests don spring up for oda parts of di world

Wia dis foto come from, Getty Images