Israeli strike kill Hezbollah commander for Lebanon - Sources

High rise building wey Israeli air strike hit for Beirut as pipo dey inspect di damage to di blocks of flats for di southern suburbs of di Lebanese capital.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, High rise building wey Israeli air strike hit for Beirut as pipo dey inspect di damage to di blocks of flats for di southern suburbs of di Lebanese capital.
Read am in 7 mins

One top Hezbollah commander, Ibrahim Aqil don die for one Israeli strike for di southern suburb for Beirut according to reports by Reuters and di AFP news agency.

Aqil die alongside members of Hezbollah elite Radwan unit as dem bin dey hold meeting.

Hezbollah operations commander Ibrahim Aqil according to tori, na di target of Israel strike.

Aqil wey pipo sabi as Tahsin, na key leader for Hezbollah.

For 1980, im be member of di group wey plan di bombing of di US Embassy for Beirut and marine barracks. Di attacks killed 63 and 307 pipo.

For 2019, di US name Aqil as a terrorist and one Justice Department website tok say im dey serve on Hezbollah highest military body - di Jihad Council.

Last year, di US State Department bin tok say dem go give a $7m (£5.2m) reward for information wey fit lead to di identification, location, arrest or conviction of Aqil.

How Hezbollah fire rockets to Israel as revenge and Israel fire back

Di Israeli military says dem don carry out one "targeted strike" on di Lebanese capital Beirut, afta Hezbollah fire more dan 100 rockets into Israel to revenge.

Lebanon health ministry say three pipo die and 17 wound for di attack wey happun for di suburb for southern Beirut.

Tori be say di Israeli strike bin target senior Hezbollah commander Ibrahim Aqil.

Dis dey come afta more dan 30 pipo die sake of series of exploding device attacks on Hezbollah members early dis week, wey dem blame Israel for.

Hassan Nasrallah, di Iran-backed group leader, vow to revenge for im speech on Thursday

Israel air strike on Beirut na di third wey don happun for di Lebanese capital dis year.

One strike bin happun for July wey kill Hezbollah military chief, and anoda one bin happun for January wey kill Hamas deputy leader.

Map wey dey show heavy security presence of Hezbollah members wey dey stop journalists from getting close to di location, di area dey very populated Di atmosphere for dia dey very tense.

Wia dis foto come from, BBC/GOOGLE

Wetin we call dis foto, Dahieh, Hezbollahstronghold for southern Beirut, and di streets around di site of di airstrike don close.

Hezbollah revenge Isreal attacks

Afta Hezbollah leader, Hassan Hasrallah promise say dem go revenge di attacks wey Israel dey sama dem since dis week.

Hebollah keep to dia promise as dem fire 100 rockets into Israel on Friday.

Like many of di rockets wey dem first on Friday morning, di fly go outside Israel evacuation zone wey dey along di Lebanese border.

Rosh Pina dey around nine miles from di border. Sarit Zehavi, former IDF intelligence office who dey rub one tink tank for di north, tok say since June, many of Hezbollah rockets bin don dey landing beyond di evacuation zone.

Meanwhile sirens and a volley of rockets fly over Rosh Pina but wit many blockings.

Wetin bin happun?

Kasala bin start for Lebanon afta Israel launch air strikes on southern Lebanon.

Hezbollah leader Hassan Nasrallah bin condemn di fatal exploding devices attacks wey happun dis week.

Moments bifor Nasrallah read dia speech for television, Israel confam fresh strikes.

For Beirut dem also hear as Israeli fighter jets breaking sound barrier over di capital

Nasrallah say di device attacks - wey kill at least 37 pipo na - "a declaration of war" and say Israel "no even consider innocent pipo”

More dan 2,600 pipo bin wound wen thousands of pagers explode on Tuesday and walkie-talkies explode on Wednesday

Multiple sources say Israel Mossad spy agency bin dey target Hezbollah. Israel neva tok about di mata, but on Wednesday, Defence Minister Yoav Gallant announce "a new phase for di war"

'We go ansa dem' - Nasrallah

Di speech wey Hezbollah leader, Hassan Nasrallah na im first public reaction since di plenti attacks for Lebanon in di last couple of days.

And pipo bin dey expect strong words from am against Israel.

For di speech im refer to di kontri as “di enemy” don cross “all limits, rules, and red lines” wit di explosions wey kill at least 37 pipo and wound more dan 3,000 pipo.

Im describe di attacks as massacre, and agree say di attacks na big blow for di group but dia ability to command and communicate still dey intact.

Im add say dem don launch one investigation to chook eye into how e happun.

“We fit call am war crimes or a declaration of war - anyhow you choose to call am, e dey okay and e fit di description. Dis na wetin di enemy bin plan,” im tok.

Im vow say demgo get beta punishment but, unsurprisingly, nobody bin know how dis response go be.

Di cross-border attacks on Israel go kontinu unless ceasefire dey for Gaza. im add say dem no go allow di pipo wey dey stay for northern Israel wey dey displaced sake of di kasala to comeback.

Di tone, again, show say di group go measure dia reaction so dat dem no go spark a major war wit Israel, wey fit spoil many times, not just for di group but e fit destroy Lebanon, a kontri wey dey struggle to recover from multiple crises in recent years.

Im add say for di last two days, Israel bin try to kill 5,000 pipo in two minutes, and say di blast na di first for di history of both Lebanon and di world.

We no doubt say "dem break in-to us", im tok.

IDF says two soldiers killed near Lebanon border

published at 16:53 British Summer Time

Meanwhile di Israeli military say dem don kill two of dia sojas near Israel northern border wit Lebanon.

Di two men wey dey 43 and 20 years, "fell in combat", dem tok for statement, dem add say na for near di Lebanon border dem kpai dem.

Some fotos from di Hezbollah revenge and Israel response

New pictures of di damage wey don happun as Hezbollah fire 100 rockets to Israel and Israel also strike back.

Dis na to give idea of how di damage to some of di buildings wey Israeli strike hit as crowds of pipo gada for di place.

Foto from northern Israel, wia firefighters dey try to quench flames from series of Hezbollah rocket attacks from Lebanon on Friday. Dem take di fotos near di border, for di Israeli-occupied Golan Heights:

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Foto from northern Israel, wia firefighters dey try to quench flames from series of Hezbollah rocket attacks from Lebanon on Friday.
High rise building wey Israeli air strike hit for Beirut as pipo dey inspect di damage to di blocks of flats for di southern suburbs of di Lebanese capital.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, High rise building wey Israeli air strike hit for Beirut as pipo dey inspect di damage to di blocks of flats for di southern suburbs of di Lebanese capital.
Di damage wey di strike cause for ground and buildings wey di Israel strike hit.

Wia dis foto come from, ANWAR AMRO/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Di damage wey di strike cause for ground and buildings wey di Israel strike hit.
Di damage wey di strike cause for ground and buildings wey di Israel strike hit.

Wia dis foto come from, ANWAR AMRO/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Di damage wey di strike cause for ground and buildings wey di Israel strike hit.
Images from Dahieh show smoke over di area, wey be Hezbollah stronghold for southern Beirut.

Wia dis foto come from, Reuters