Saudi Arabia, Air Peace mata – Wetin don happun so far

Wia dis foto come from, INSTAGRAM/FLYAIRPEACE
Tori don plenty about how Saudi Arabia bin cancel 177 Nigerians visa mid-flight as dem dey travel on Sunday.
Di kasala burst afta di 264 passenger Air Peace flight bin land for Jeddah.
Tori be say na ony 87 pipo dem give clear road to enta while do odas bin collect about turn back to wia dem come from.
Di tori bin loud on top say nobody bin know wetin cause di mass deportation of pipo wey don collect visa and everytin to waka go.
Affected passengers bin tell local tori pipo say e shock dem wen dem hear say dem don cancel dia visa wen dey land.
Dis na as dem say dem bin don meet all di requirements to take enta di Middle East kontri.

Wia dis foto come from, Getty Images
But on Wednesday, di Saudi Arabia embassy for Nigeria reveal say di pipo wey dem do back to sender for bin no fulfil entry conditions.
For statement dem say, di passengers "bin submit wrong information to get di kain visa wey no apply to dem, wey dem find out on dia arrival."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di aeroplane carrier, Air Peace, howeva deny wtin Saudi Arabia tok.
For statement wey dem put out di same Wednesday, dem tok say, "di visas bin dey verified with di use of di visa confirmation platform wey di Ministery of Foreign Affairs Saudi Arabia give, wey confam say di visa of each passenger dey valid before dem go fit allow dem to check in for di flight."
Dem add say even di immigration officers for Saudi Arabia bin shock on top di way dem cancel di valid visas.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Meanwhile, di Nigerian Ministry of Foreign Affairs reveal on Tuesday say even though dem neva hear di full tori on top wetin cause di cancellation, dem sabi say 18 of di passengers bin collect ban.
Di statement tok say, "di Saudi authorities neva give reason of di cancellation of vis except for 18 of di passengers wey be say don collect ban from Saudi Arabia on top di different offences dem don commit before."
Dis na as dem add say even though di kontri get right to allow who dem wan to come dia kontri to enta, di mata of say Nigeria and Saudi Arabia be traditional and strategic partners wey no want make dis kain tin happun again dey chook eye take investigate di mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis na as di Ministry call for di calm of di passengers wey di Saudi goment bin deport.
Di calm message dey important to note because tori be say, many of di deported Nigerians bin go on di trip because dem bin wan take part in di pilgrimage to di Islamic holy city of Mecca.
Dis na as di Nigeria President Bola Tinubu bin dey Saudi Arabia on Sunday to perform im Umrah rituals for di Grand Mosque.












