DR Congo anti-UN protests - Tins we learn

UN force in DR Congo

Wia dis foto come from, AFP

Democratic Republic of Congo don ask di tok-tok pesin of di UN peace-making force for di kontri make e comot sharp-sharp.

Di foreign ministry accuse Mathais Gillmann say im tok "indelicate and inopportune statements".

Last week, violent protests bin kill about 30 pipo for eastern DR Congo wey bin dey ask di UN force alias Monusco to comot.

Di demonstrators bin hala say since di UN mission land di kontri, dem neva fit to stop di violence by rebels dia.

So, we think am say make we sama una some of di key gbas gbos wey dey happun dia

When di conflict start

Di conflict for DR Congo na combination of plenti-plenti gbas-gbos wit plenti players dem.

Although, rebels start to enta di picture for 1996, na for 1960 kasala first burst for di then Zaire to declare Katanga independent.

How many rebels dey

As at now tori be say dem be ova one hundred rebel groups wey dey cause kasala for eastern DRC.

Of those number na three dey make di greatest noise, dem be ADF (Allied Democratic Forces), CODECO and M23 rebels.

Human rights watch do report wey say di M23 rebels bin execute at least 29 pipo in di last month for di eastern region of DR Congo.

Wetin rebels want

M23 rebels dey find jobs for DR Congo and want make goment fight di rebels wey dey disturb dia pipo wey don become IDPs for Uganda and Rwanda.

ADF originally come from Uganda wia dem bin dey fight agaist persecution of Muslims, but since dem enta DRC as members of di so-called Islamic state.

Wen UN show

Na for di year 2000, di United Nations Security Council bin first send 5,500 UN force to monitor cease fire wey di Congolese Liberation Movement (MLC) rebels supported by Uganda and Rally for Congolese Democracy (RCD) rebels backed by Rwanda follow sign, di year before.

Dem send anoda 3,000 UN Brigade for July 2013.

Wetin UN Forces do for dia

UN forces bin originally come di kontri for 2002 to monitor ceasefire wey rebels and di goment bin sign for 1999.

But as at 2022, na ova 18,000 personnel for di kontri. Dis na do second largest UN mission for di world.

Dem dey on peacekeeping mission and di aim na to bring peace and stability to region.

For 2010, di new frce Munsco take ova from di former UN force.

Peace toks wit rebels

Plenti peace toks for dis decades long kasala for DR Congo.

Even sef some lead to ceasefire as recent as May dis year but M23 rebels break am untp say dem no invite dem come di tok-tok table.

UN Peacemakers deaths

During di latest anti Un protests wey happun for DRC, four UN peacemakers in die as di protests turn violent.

Dis na as two UN bases bin dey attacked with petrol bombs.

But, apart from dat, attacks inside UN camps by rebels don almost become normal.

For June, rebels bin attack one UN camp even though reports show say causalities no dey.

UN Peacemakers killings

Howeva accuse don full up and down say peacemakers for di area.

Last Sunday, UN confam say some Tanzanian peacemakers bin kill two and injure fifteen for inside one shooting wey hapun for DRC border town with Uganda.

Tori be say di US forces bin dey try force dia wey enta DRC afta dem finish dia leave for Uganda.

DR Congo and Rwanda kasala

Rwandan President Paul Kagame and DR Congo's Félix Tshisekedi for toks for Angola

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Rwandan President Paul Kagame and DR Congo's Félix Tshisekedi for toks for Angola

President Felix Tshesekedi recently accuse Rwanda say dem dey support and fund di M23 rebels for dia fight with goment forces.

Howeva both Rwanda and di M23 rebels don deny di accusation several times. Howeva di mata deep sotay e cause di two kontris to get wahala with each oda sotay diplomatic relations sour.

Until Angola come host peace toks between di two kontris presidents, even sef Rwanda presido, Paul Kagame bin say e no get much hope for di outcome.

Howeva for July 7, both Tshisekedi and Kagame agree to restore trust and de-escalate tensions.

IDP situation for Congo

Reports say ova 700,000 pipo don run comot dia houses for Ituri and North Kivu since di start of dis year.

United Nations refugee agency (UNHCR) but di number of pipo wey don run comot dia homes for DRC don reach 4.5 million pipo.

Dem say dat na di number of pipo wey go need sleep inside church, street or for outside because even dem sef no get enough money to help.

Di agency report say since April, di number don pass 160,000 wey kasala don drive from dia houses.