Police arrest House on the Rock pastor wey cari 'AK-47' climb pulpit

Pastor Uche Aigbe

Wia dis foto come from, House on the Rock Church,

Di Federal Capital Territory (FCT) Police Command don confam di arrest of one resident Pastor of di House on the Rock church for Abuja, and two odas.

Di arrest of Pastor Uche Aigbe dey come afta one foto of wia e carry AK-47 on top altar dey preach go viral.

FCT Police tok-tok pesin, Josephine Adeh for inside statement say dem arrest di pastor for di early hours of Monday 13th February 2023, along side di Church Chief Security Officer and one Inspector Musa Audu, wey dey on duty on di said day, afta “various media and social media users describe im message and demonstrations as inciting.”

Dem arrest di police inspector because e “unprofessionally release im rifle to di said pastor without permission.” Di statement partly tok.

Di police advise say as investigation into di case don start, make pipo avoid actions or tins wey dey against di law.

Di senior pastor for Nigeria become hot topic of discussion ontop social media over di weekend afta video show am cari rifle climb ontop pulpit wia im dey deliver sermon.

Wetin make Pastor Uche cari AK47 climb pulpit?

2Be on your guard; stand firm in di faith; be courageous; be strong."

Na im be di theme of di sermon on Sunday, according to wetin di church put for dia Facebook page.

So pastor Uche cari di gun climb pulpit to use as illustration on why church members ‘need to cari dia guns and defend dia faith’

“E get some tins wey no get anytin to do wit di gospel, God no be magician, God no be diviner, yes, im sabi anytin from di past to di future, but im no dey use your past to manipulate you, na why you need to cari your guns and defend your faith” Pastor Uche tok.

Wen im first climb di pulpit, di church members bin first laugh at di unusual sight of di gun wey im strap to im back, but di senior pastor say make dem no “go anywia, stay dia, I come prepared dis morning because I need to guard my faith”, e tok as e raise di gun up to show dem wetin e mean.

“We dey live in a time wia we need to protect our faith, we need to guard our faith against hoodlums, against bandits, against wicked pipo wey dey seek to turn di faith of God for our lives, make dem fit not stop wetin God wan do for our lives”, e add am.

Meanwhile, di sight of AK-47 for church make pipo tok on social media as some pipo defend di action say e dey clearly use am to illustrate, odas wonder if e dey right for am to even own a gun or bring am come church to perform.

How pipo react

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Police dey investigate

Nigeria police bin say dem don begin investigate if true-true, di pastor cari AK-47 enta church.

For one twitter post wia im dey respond to one twitter user, di police tok-tok pesin Muyiwa Adejobi say if na true, di pastor get case to answer

“AK47??. e fall under di prohibited Firearms for Nigeria, and no one dey cari am except an officer of di law, and no be all of dem get di right, but no individual get di right to bear am.” E tok.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4

Nigeria gun law dey for di Firearm Act chapter 146 of Laws of di Federal Republic of Nigeria 1990.

Di Firearm Act make provisions for how to take own or carry plus deal in firearm or guns and ammunitions or bullets and missiles.

According to dis law, nobody fit carry any personal gun except im collect license from di Inspector General of Police (IGP).

Di IGP get di power to give or refuse to give dis license according to wetin di National Council of Ministers decide.

Based on dis law, e no be anybody right or entitlement to own a gun.

"Subject to di provisions of subsection (5) of section 5 of dis Act, no person shall, as of right, dey entitled to di grant of any licence or permit under dis Act,

"And di authority wey get di function of granting such licence or permit fit without being bound to assign any reason, therefore refuse di grant of such licence or permit or, subject to di provisions of any regulations under section 33 of dis Act,

"Dem fit impose such terms or conditions as e reason am, and fit revoke such licence or permit for such cause as dem consider appropriate."

Section 7, subsection 2 (a- e) of di Act say:

Notwithstanding di provisions of subsection (1) of dis section, no licence or permit under di provisions of dis Act shall be granted if reason dey to believe say di applicant or holder of di licence-

(a) dey under the age of seventeen;

(b) dey of unsound mind;

(c) no dey fit to have possession of di firearm in question on account of defective eyesight;

(d) na pesin wey im habits no show self-control

(e) don during di previous five years dey convicted of offence involving violence or di threat of violence.

Na so part of di law read.