President Donald Trump inauguration in fotos

Trump dey give in first inauguration speech

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 7 mins

Donald Trump give im inaugural speech as president by addressing im fellow presidents and odas wey dey attend di event, including former Vice-President Kamala Harris and former President Joe Biden.

Di incoming President Donald Trump tok many tins including plan to declare a "national emergency" for di US-Mexico border.

Dis na as part of di many executive orders wey e intend to sign to shaparly reverse di Biden administration policies.

"Di golden age of America begin right now," im tok. "From dis day forward, our kontri go flourish and dey respected.

"I go very simply put America first."

Di new president say, "to most Americans, January 20, 2025 go be liberation day!"

Donald Trump don officially become di 47th President of di United States.

Wia dis foto come from, Getty Images

'America decline is over'

Trump say dem give am mandate to "completely and totally reverse" wetin im call "horrible betrayal" by pipo in power against di American pipo.

E add say im go give pipo "dia faith, dia wealth, dia democracy and d freedom."

"From dis moment on, America decline is over," im say.

'Drill baby drill'

Di president tok about tackling inflation and rising energy costs for Americans – one main point for im campaign.

Im say im go direct all members of cabinet to do wetin dey dia power to do to "defeat" inflation and "rapidly bring down costs and prices".

Trump add say im go declare national energy emergency, and repeat im promise say im administration go drill of oil and gas on US soil.

"America go be manufacturing kontri once again," im say, adding say America dey sit on "di most oil and natural gas of any kontri on earth, and we go use am."

"Drill baby drill," im say to applause.

US country singer Carrie Underwood

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US country singer Carrie Underwood sing America Di Beautiful ... acappella afta Trump inauguration speech.After her backing track stop seconds in, few seconds of silence follow as former presidents look around to see wetin dey happun.Underwood begin to sing acappella - along wit help from di inauguration audience.

President hit Biden-era policies

Joe Biden reaction as Trump dey tok

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mixture of reactions on display inside Capitolas Trump dey give im speechInside Rotunda, Trump dey receive plenty applause and cheers from pipo wey sidon fr im front. Many stand as dem dey listen to di president speak.But na different story for di officials wey sidon behind am, wey include im former presidential opponent Kamala Harris and former President Joe Biden.

Trump use im first speech to attack Biden administration and how e take handle migrant crisis.

E say im goment go "annihilate", di kontri challenge and confront di crisis of "trust over radical and corrupt establishment".

E say di former administration provide sanctuary and protection for "dangerous criminals" wey illegally enta di kontri.

Di goment don give "unlimited funding to defence of foreign borders" but refuse to defend American borders, im claim.

"We now have a government that cannot manage even a simple crisis at home," Trump says.

E say for im goment: "We no go forget out kontri, we no go forget our constitution, and we no go forget our God."

Trump officially swear in as president

Donald Trump officially become di 47th President of di United States.

During in swearing in, im swear to "preserve, protect and defend" di Constitution.

Dis na di first time since di 1890s wey US president wey dem bin defeat for election dey return victorious to take oath for a second time.

Cannons fire salute as dem di choir dey sing Hail to the Chief soon afta Trump take im oath.

Den dem come sing, Battle Hymn of di Republic.

Na two bibles dem take swear am into office - one wey im mama bin give am, and di Lincoln Bible.

Several oda previous presidents bin use dis bible - including Abraham Lincoln for 1861.

JD Vance as dem swear am in as official vice-president of di United States.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, JD Vance as dem swear am in as official vice-president of di United States.
Donald Trump as im arrive di Rotunda to take oath of office

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump as im arrive di Rotunda to take oath of officeNa here dem swear am in as 47th president of United States.Im wife, di current president and vice president, and im soon to be vice president all enta moments before am.
Di crowdfor Capital One Arena stand as dem see dia soon to be 47th president waka enta di rotunda a mile or so away.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di crowdfor Capital One Arena stand as dem see dia soon to be 47th president waka enta di rotunda a mile or so away.
Over 200,000 tickets na im dey sell to pipo wey go watch di inauguration outside before freezing temperatures make am impossible

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, In departure from tradition, today inauguration happun inside Capitol.Historically, presidents dey take dia oath outside in front of plenty crowds.However, bitterly cold temperatures - forecasters don predict lows of -11C (12F) - for Washington DC mean say dem gatz shift di programme inside to di Capitol Rotunda.Over 200,000 tickets na im dey sell to pipo wey go watch di inauguration outside before freezing temperatures make am impossible
President Biden and im wife Jill welcome Donald Trump and Melania to di White House. Dem sidon for tea, before heading to Capitol.
Dis na di first time di two couple dey meet today.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Biden and im wife Jill welcome Donald Trump and Melania to di White House. Dem sidon for tea, before heading to Capitol.Dis na di first time di two couple dey meet today.
Soon to be sworn-in US president Donald Trump as im leave di cathedral wit im wife, Melania, afta di 25 mins service for St John's Church.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Soon to be sworn-in US president Donald Trump as im leave di cathedral wit im wife, Melania, afta di 25 mins service for St John's Church.
Melania Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For her church service look, Melania Trump wear coat by New York designer Adam Lippes, and hat by anoda American designer, Eric Javits.During di first Trump inauguration, Melania bin face challenge, as many American designers either openly or more quietly refuse to dress her.Ralph Lauren, one long-time Democrat wit sense of duty to di office of di president, bin provide di blue suit wey she wear on dat day.In response, pipo bin use #boycottralphlauren hashtag to fight am.
Tech billionaires Mark Zuckerberg and Jeff Bezos follow among di tech ceos wey attedn do service. White House pool report say Meta Oga Zuckerberg, Amazon Jeff Bezos and Lauren Sanchez, as well as former British Prime Minister Boris Johnson bin all sidon for di same row.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tech billionaires Mark Zuckerberg and Jeff Bezos follow among di tech ceos wey attedn do service. White House pool report say Meta Oga Zuckerberg, Amazon Jeff Bezos and Lauren Sanchez, as well as former British Prime Minister Boris Johnson bin all sidon for di same row.
JD Vance, im wife, President-elect Trump and im wife Melania during di inaugural service

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, JD Vance, im wife, President-elect Trump and im wife Melania during di inaugural service
Donald Trump and im wife, Melania, arrive St John's Church, marking di first time wey we see di president-elect on inauguration day.
The church service wey be tradition for incoming presidents begin 08:30 local time (13:30 GMT).

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump and im wife, Melania, arrive St John's Church, marking di first time wey we see di president-elect on inauguration day.The church service wey be tradition for incoming presidents begin 08:30 local time (13:30 GMT).
US Vice-President-elect JD Vance and im wife Usha Vance as dem also arrive St John's Church for di service, moments before Donald Trump and im wife Melania arrive.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, US Vice-President-elect JD Vance and im wife Usha Vance as dem also arrive St John's Church for di service, moments before Donald Trump and im wife Melania arrive.
Trump supporters begin to take dia seats inside di Capital One Arena - full eight hours before Donald Trump bin dey due to speak here afta im formal swearing for Capitol.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Trump supporters begin to take dia seats inside di Capital One Arena - full eight hours before Donald Trump bin dey due to speak here afta im formal swearing for Capitol.Di few hundred wey take dia seats dey wrapped up warm against di extremely cold Washington temperatures. Dem also wear dia red Maga hats.